Meet Hilary Maduba wey defy body shaming to become catwalk coach, pageant instructor

Wetin we call dis Video, Hilary Maduba wey defy body shaming to become catwalk coach, pageant instructor
Meet Hilary Maduba wey defy body shaming to become catwalk coach, pageant instructor

One NIgerian man say im fall im love wit cat walking afta im watch Ezinne Akudo win Miss Nigerian beauty pageant for 2013.

Hilary Maduba say di pageant inspire am well-well becos im childhood friend Olive Sadiq bin contest and finish as second runner up.

Na afta dat pageant im journey into cat walking take start.

Physically Maduba no look like your typical cat walk instructor sake of im big size.

But dat no stop am to achieve im dreams.

"I watch plenty videos and I learn and practice", Maduba tok.

Five years afta di pageant im open im own agency Hilz Academy for Port Harcourt wia im dey train models and pipo wey dey contest for pageants on how to carry demself.

Hilary Maduba
Hilary Maduba
Wetin we call dis foto, Hilary Maduba

Maduba say im dey very happy wit wetin im don achieve even wit all di bad mouth wey im don get from pipo sake of wetin im dey

E add say Im family dey fully behind am – “di bad comment wey pipo don tok so far plenty. Dem be like wetin make man go be catwalk instructor. E get one wey tok say see as im fat, make im no go die oh.

“How I dey feel about those comments I no tok say I no be human being. E get some wey dey touch me once – once. I don tell myself say I no go reason wetin pipo dey tok.”

Hilary Maduba
Wetin we call dis foto, Hilary Maduba
Hilary Maduba

Produced by: Fiona Equere

Video by: Monday Idara