How world leaders react to India strikes on Pakistan for 'Operation Sindoor'

Read am in 9 mins

World leaders don tok dia mind about di attacks between India and Pakistan, two neigbours wey dey nuclear-armed.

India say im bin do revenge attack on Pakistan early momo on Wednesday afta one deadly attack on tourists for Kashmir last month.

Dem use missiles strike nine sites inside Pakistan and di Kashmir wey Pakistan dey run.

World leaders react by condemning di attack wey dem dey worry say, if di two sides no manage well, fit enta full scale military war between di two kontris.

World leaders reaction

U.S. President Donald Trump

Reacting to di attack, US President, Donald Trump say: "Na shame. I just hear about am. I guess pipo bin sabi say sometin go happun base on small small tins from di past. Dem don dey fight for a long time. Dem don dey fight for many, many years. I hope say e go end very quickly."

Tok Tok Pesin for U.N. Secretary-General Antonio Guterres

"Di Secretary-General dey very concerned about India military operations across di Line of Control and international border. Im dey call for maximum military restraint from both kontris. Di world no fit to afford military confrontation between India and Pakistan."

Japan Chief Cabinet Secretary Yoshimasa Hayashi

Japan Chief Cabinet Secretary Yoshimasa Hayashi say: "In regard to di terrorist act wey happun for Kashmir on April 22, our country firmly condemn dat kain act of terrorism. Furthermore, we express strong concern say dis situation fit lead to more revenge exchange and turn into full-scale military conflict. For di peace and stability of South Asia, we strongly beg both India and Pakistan make dem hold demsef and stabilise di situation through tok-tok."

China Foreign Ministry Tok tok pesin

"China see di India military operation wey happun early dis morning as regrettable. We dey concerned about di ongoing situation. We beg both sides to act in di larger interest of peace and stability, remain calm, exercise control and stop to dey take actions wey fit complicate di situation."

British Foreign Minister David Lammy

"Current tension between India and Pakistan na serious concern. Di UK goment dey beg India and Pakistan to show control and do direct tok tok to fins sharp, diplomatic way forward. We need all sides to work urgently to see say dem restore regional stability and make sure say dem protect civilians."

Russian Foreign Ministry Tok tok pesin

"We dey deeply concerned about di increase of military confrontation between India and Pakistan afta di terrorist attack near Pahalgam. We call on di parties wey dey involved to control demsef so dem go fit prevent di further break-down of di situation for di region."

French Foreign Minister Jean-Noel Barrot

"We call on India as well as on Pakistan to show control of dem sef in order make di situation no catch fire. Nobody dey gain anytin from prolonged confrontation between India and Pakistan. Dis two na major military powers, dat na why we call for restraint".

United Arab Emirates Foreign Ministry

"Deputy Prime Minister and Minister of Foreign Affairs of UAE, Sheikh Abdullah bin Zayed, don call on India and Pakistan to exercise control, reduce tensions, and avoid more increase wey fit to threaten regional and international peace."

Israel Ambassador to India Reuven Azar

Israel Ambassador to India Reuven Azar loud im kontri support for India attack as im say: "Israel support India right for self defence. Terrorists suppose know say e no get place to hide from dia wicked crimes against di innocent."

Egypt Foreign Affairs Ministry

"Egypt dey follow wit great concern di current developments between India and Pakistan, calling on both sides to exercise di highest levels of restraint and uphold discussion through diplomatic channels. Di ministry dey stress di need to put in effort to calm di crisis and avoid further escalation."

Wednesday morning attack

Di Indian strike on Wednesday morning happun as tension dey between di two neighbours after a deadly attack last month on tourists for di part of Kashmir wey India dey run.

For statement, di Indian goment say, "nine sites na im we target".

"Our actions dey focused, measured and non-escalatory in nature. No Pakistani military facilities dey targeted. India don show considerable restraint in selection of targets and method of execution."

Di statement add say dem order di attack afta last month deadly militant attack on tourists for India-administered Kashmir.

Indian Home Minister Amit Shah praise di kontri country armed forces in a post on X, saying e dey proud of dem.

Operation Sindoor - India name for dia strikes on Pakistan – na di kontri response to di "brutal killing of our innocent brodas for Pahalgam", e write.

"Di Modi goment don resolve to give a proper response to any attack on India and dia pipo. Bharat [India name in di Hindi language] remain firmly committed to remove terrorism from id roots," e add.

Meanwhile, Pakistan claim say dem shoot down five Indian aircraft.

"So far, I fit confam to you say five Indian aircraft - including three Rafale, one SU-30 and one MiG-29 - and one Heron drone don dey shot down," Pakistan military tok-tok pesin Lt-Gen Ahmed Sharif Chaudhary tok for video wey Reuters share.

India neva react to dos claims yet.

Wetin cause di strikes by India?

India strikes come in revenge to one militant attack wey kill at least 26 pipo, mostly tourists for di part of Kashmir wey India dey run.

Militants open fire on pipo wey dey visit Baisaran, one mountain-top meadow three miles (5 km) from Pahalgam.

Some survivors of di attack say di main targets of di gunmen na Hindu men.

Pakistan don deny say dia hand dey inside di attacks, but Indian police say two of di four militants wey dem suspect for di attack na Pakistani citizens. Security forces still dey try catch di suspects.

Both India and Pakistan don announce series of revenge measures against one anoda including to close borders and suspend a river water sharing agreement. Troops from both sides don also exchange small arms fire.

Indian prime minister Narendra Modi bin don earlier tok say di kontri go chase di pipo wey carry out di attacks "to di ends of di Earth".

Indian officials give detail of air strikes

Foreign Secretary Vikram Misri tok about di detail of last month attack in Indian-administered Kashmir wey "Pakistani and Pakistan-trained terrorists" allegedly carry out. E no share any evidence of dis during di press briefing.

E blame di attack on The Resistance Front (TRF), describing dem as front for Lashkar-e-Taiba, one group based in Pakistan, India describe am as terrorist organisation.

Soon afta di attack, one social media post appear claiming to dey tok on behalf of di TRF, dem tok say dem dey behind di killings. But di TRF later deny involvement saying someone wit access to dia social media account don wrongly claim role in di attack.

Pakistan don deny any involvement in di Pahalgam attack and ask India make dem show any evidence if dem get. E neva respond to India latest claims.

Oga Misri tok say Indian intelligence monitoring of "Pakistan-based terrorist modules" indicate say further attacks against India still dey impend.

Pakistan tok say 26 pipo don die in Indian air strikes

Pakistan military tok-tok pesin Lt Gen Ahmed Sharif Chaudhry tok say 26 pipo die and 46 injure inside di Indian air strikes and firing along di Line of Control - di de facto border between di kontris.

Pakistan bin tok say na eight pipo die

For dia briefing, one Indian army officer tok say dem no get "reports of civilian casualties for Pakistan".

BBC don confam 10 civilians wey don die and 32 wey injure for Indian-administered Kashmir, afta Pakistan launch heavy artillery shelling along di de-facto border between di kontris in response to Delhi air strikes.

Di firing dey serious for Poonch and Mehandar regions, locals tell BBC. Several buildings, including houses and shops, dey badly damaged.

"We hear loud explosions for hours on Wednesday night," Zamrood Mughal, one local journalist from Poonch, tell BBC ova di phone.

"Pipo no fit sleep di entire night. Dem abandon dia homes and run to safer locations," Mughal tok

"Our local hospital don full of pipo wey wunjure."

Meanwhile, dem don cancel nearly 550 scheduled flights for India and Pakistan since di air strikes.

Dem cancel 16 % of all scheduled commercial flights for Pakistan and 3% for India since di air strikes, according to data from real-time flight tracking service Flightradar24.

For Pakistan, dem cancel 135 flights while dem cancel 417 flights in India, according to di tracker.

India leading airlines don issue travel advisories for civilians wey dey affected due to di closure of several airports in di northern part of di kontri.

History of di India-Pakistan conflict

Since dia creation for 1947, India and Pakistan don fight multiple wars - most centred on Kashmir.

Di first happun just months afta partition, ending 1949 UN-brokered ceasefire wey split di region but leave both nations claiming am in full.

In 1965, dem fight again wen Pakistani forces cross into Indian-administered Kashmir, leading to fierce ground and air battles.

In 1971, war happun ova East Pakistan, wia India support independence forces, ultimately leading to di creation of Bangladesh.

For di 1999 Kargil conflict, Pakistani troops infiltrate Indian-administered Kashmir; na di first clash betwin di nuclear-armed rivals, sparking global alarm.

In more recent years, tensions don dey rise afta militant attacks: India launch "surgical strikes" for 2016 afta di Uri attack and conduct airstrikes near Balakot for2019 following di Pulwama bombing.

Pakistan respond wit dia own air incursions, marking one of di most dangerous escalations since Kargil.

'Our house burn down but luckily we survive' - Voices from one hospital for Baramulla

BBC don visit di main hospital for Baramulla district for Indian-administered Kashmir, wia four pipo injure in cross-shelling betwin Indian and Pakistani forces dis morning.

Manzoor, 18, dey sleep on di first floor for im house for Uri - one town wey dey near di de-facto border between di two kontris - wen sometin fly through di window and injure im arm.

Doctors tok say dem go need to perform surgery to remove di splinter.

Badardin Naik and two family members dey receive treatment for di same hospital, .

All of dem injure wen artillery shell hit dia home for Salamabad in di early hours of Wednesday.

Naik and im eight-year-old son sustain head injuries, while im sister-in-law get blood clot for her chest. She dey for surgery.

"Our house burn down, but luckily we survive," Naik tok.