'Canada no go ever dey for sale' - Carney warn for im meeting wit Trump one week after e win election

    • Author, Bernd Debusmann Jr
    • Role, Reporting from the White House
  • Read am in 3 mins

Canadian PM Mark Carney don say Canada is "not for sale" as US President Donald Trump insist say di country go benefit from becoming di 51st US state.

E tok as di US president meet with di new Canada prime minister Mark Carney, for di White House just a week after e win di federal election.

Dis dey come after months of mounting tensions between di neighbours.

Trump tariffs and repeated comments about making Canada di 51st US state don be focus for politicians - and a concern for many Canadians.

US president bin don say Canada opposition to im proposal no go get any impact on dia discussions.

Speaking from di Oval Office, Trump bin say, "we go be friends with Canada" regardless of di current tariff palava".

Four key takeaways from Trump and Carney meeting

Di US president dominate di discussion, but on certain points Carney make Canada position clear. Dis na a quick recap:

Dem ginger each oda: President Trump say na "honour" to host di Canadian prime minister afta im election victory. Carney return di compliment give Trump, e call am a "transformational president".

'A very big announcement': Na wetin Trump drop hint about say dey come in di coming days. Several times e tok am, but e refused to go into any detail.

51St US State: Trump tok again about im threat say Canada fit become di 51st US state. Carney insist di country no go "ever be for sale". Trump reply say: "Never say never".

No going back on tariffs: Wendem ask Trumpif anything dey wey Carney fit tok to suspend US tariffs, Trump reply say: "No." Carney, for im part, say di trade agreement between US, Mexico and Canada na di "basis for broader negotiation".

Analysis of how di meeting go by BBC tori pesin

I suspect say both sides go assess dat meeting say na positive outcome.

Na so BBC tori pesin Bernd Debusmann Jr tok.

Even if clear points of friction bin dey - like tariffs and Trump "51st state" remarks - Bele go sweet Carney and di Canadian delegation say dem avoid wetin Trump refer to as "dust up" for di Oval Office.

While Trump no call im name, e bin dey use style refer to Volodymyr Zelensky and dia ogbonge Oval Office meeting, wey bin cut short after dem get friction and di Ukrainian leader go home empty handed.

Unlike Zelensky, Carney handle di meeting with diplomacy and tact.

While no strong announcements come out today, di two appear to don end di meeting with mutual respect, willing to engage one anoda and - dia hope - wey be to dey constructive.

Although na bilateral meeting between di US and Canadian leaders - but Trump na di one wey dominate.

Carney appear to only fit come in occasionally as Trump dey in charge.