'E dey disrespectful' – Ademola Lookman reply Atalanta coach afta penalty comment

Wia dis foto come from, Getty Images
E be like say all no dey alright for di back room of Italian side Atalanta.
Dis na as dia forward Ademola Lookman reply im manager afta dia loss to Club Brugge for dia Champions League game on Tuesday night.
Atalanta fall 3-1 to Club Brugge in di second leg of dia play-off tie for di Gewiss Stadium.
Lookman come in for di second half and immediately reduce di goal margin for Atalanta.
Di Nigeria international later miss ogbonge penalty in di 62nd minute wey dash di hope of Atalanta from qualifying to di UCL Round of 16.
Di La Dea drop out of di competition wit a 5-2 aggregate score.
"Lookman na one of di worst penalty takers I don ever see," Atalanta manager, Gian Piero Gasperini tok as e blast Lookman for deciding to take di penalty.
E kontinu, "Lookman get frankly terrible record even in training, e convert very few of dem. Retegui and De Ketelaere dey dia, but Lookman in a moment of passion afta e score decide to take di ball and dat na wetin I no appreciate at all."
Wetin Ademola Lookman tok
"I dey sad say for day like today, I need to write dis statement, mostly becos of wetin we don achieve as team and city", na di first line of Lookman response.
For im four paragraph statement, di Super Eagles forward say for pesin to single am out no be better tin.
E say di tin pain am well-well becos of im hard work and commitment to help di club and happiness wey im dey always wan give di fans.
"To dey singled out like dat no only hurt e also dey very disrespectful, not just becos of di ogbonge hard work and commitment wey I don always put evriday to bring success to dis club and di ogbonge fans of Bergamo.
"True-true, I don pass through plenti hard times for my time hia, most of dem wey I no tok outside becos to me, di team suppose always dey protected and na im come first. Na im make wetin happun last night t dey more painful.
"We as team dey follow our ogbonge fans to dey pained about di results from last night. For di match, di pesin wey suppose take penalty say make I take am, and to support di team I carri responsibility for all.
"Life na about challenges and turning pain to power wey I go continue to do."









