Real Madrid vs Manchester City, and oda fixtures for di Champions League knockout play-off second leg

Harry Kane of Bayern Munich celebrate as im score im team second goal during di Uefa Champions League 2024/25 League Knockout Play-off First Leg match between Celtic FC and FC Bayern München for Celtic Park on February 12, 2025 in Glasgow, Scotland

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Harry Kane celebrate im goal against Celtic for di Uefa Champions league
Read am in 6 mins

Football fans across di world go begin chook eye for di second leg of di Uefa Champions league playoff as dem dey hope for some team to pull a come-back on Tuesday 18 February and Wednesday 19 February.

As di first leg of di Uefa Champions league playoffs don end, di playoffs see many upsets in two days.

For di matches wey dem play on Wednesday night Celtic lose 1-2 to Bayern Munich.

Bayern Much score two goals for di 45th and 49th minutes thru Micheal Olise and Harry Kane.

Na later Celtic manage score one goal afta Daizen Maeda deft header for di 79th minute.

Celtic still get hope to reach di Champions League last 16, even thogh di Scottish Premiership side lose to Bayern Munich for Glasgow.

For di oda matches, Club Brugge beat Atalanta 2-1, Monaco lose to Benfica 0-1 while Feyenoord beat AC Milan 1-0.

Photo of Mbappe scoring

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Real Madrid stage anoda comeback to win 2-3 for Etihad afta Manchester City collapse for final 5 minutes of di game

On Tuesday, Real Madrid carry advantage enta di second leg of di knockout play-off for di Champions league afta dem sama Manchester City 2-3 for England.

Na yet anoda game wia Pep Guardiola dash im opponents for di champions league dis season.

Manchester City bin take di lead afta Erling Haaland score early for di game but Kyliam Mbappe equalize bifor Haaland score from di penalty in di second half.

But anoda collapse by Guardiola im team for di last five minutes of di game make Real Madrid score 2 goals from substitute Ibrahimi Diaz and Jude Bellingham to win 2-3.

Many pipo bin complain about di Manchester City defence and dia goalkeeper Ederson di whole game as dem dey at fault for di three goals.

But Guardiola don defend im goalkeeper for one interview afta di game say "im na our best player for dis game."

Im also gree say im team neva fit handle Madrid for di last minutes of di game.

Dem bin collect seven goals for di final 15 minutes of champions league games dis season.

Real Madrid bin always show say na dem be boss for dis champions league competition as dem comeback to win yet anoda game.

Dem dey carry di 2-3 advantage for di second leg for di Bernabue on Wednesday, 19 February.

Haalaand in action

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Real Madrid get advantage to progress for di competition wit second leg for Bernabeu on 19 Feb

Oda results for di first leg of di knockout playoff

Ousmane Dembele Kontinu im scoring form dis season as im grab two goals for dia 0-3 win vs Brest.

Dembele don score for each of di last eight matches wia im play in all competitions for PSG, record wia im now dey share wit Neymar, Bianchi and Mbappe.

Di Parisien club dominate di game wia dem take di lead thru Vitinha im penalty on di 21 minute mark.

PSG go play di second leg for di parc de princes next week, wit one leg alreadi in di last-16.

Di PSG forward now get 6 goals for di competition.

Juventus also win dia game 2-1 vs PSV Eindhoven - wit goals from McKennie and Mbangula, afta Ivan Perisic score for di dutch club.

Borussia Dortmund also bin win dia away game 0-3 vs Sporting club, wia dem dey carry ogbonge advantage go Germany for di return leg.

Guirassy, Adeyemi and Pascal Gros bin score dia goals.

Dembele

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, PSG forward Dembele bin dey in form as im score 10 goals in di last four games in all competitions for di parisien club

Upcoming fixtures

AC Milan vs Feyenoord

Atalanta vs Club Brugge

Bayern Munich vs Celtic

Benfica vs Monaco

Wednesday

Borrusia Dortmund vs Sporting CP

PSG vs Brest

PSV vs Juventus

Real Madrid vs Manchester City

Background

Di Champions League knockout phase play-offs go begin dis week as 16 teams go face each oda wit di hope to join di eight wey already don make am into di last 16.

Manchester City and Celtic dey among those wey di hope to progress from dia two-leg ties - against European champions Real Madrid and Bayern Munich respectively.

But which teams dey di play-offs? And who already don go through?

Who don progress and who dey play-offs?

Manchester City bin come from behind to beat Club Brugge and squeeze dia way to for a place for di play-offs, while Aston Villa and Arsenal join Liverpool - wey don book dia place - wit automatic qualification to di last 16.

Celtic, wey bin lose 4-2 to Aston Villa for dia final league game, join City for di play-offs - all five British teams progress through di league phase.

Dis na di teams wey qualify through to each stage:

Last 16: Liverpool, Barcelona, Arsenal, Inter Milan, Atletico Madrid, Bayer Leverkusen, Lille, Aston Villa.

Knockout phase play-offs: Atalanta, Borussia Dortmund, Real Madrid, Bayern Munich, AC Milan, PSV, Paris St-Germain, Benfica, Monaco, Brest, Feyenoord, Juventus, Celtic, Manchester City, Sporting, Club Brugge.

And we already get idea of who fit play for di next rounds - City and Celtic in particular go face ogbonge tests.

Champions League route
Champions League route

Which teams are in the play-off round?

Di full draw for the play-off round look like dis:

Brest v Paris St-Germain (first leg 11 February, second leg 19 February)

Juventus v PSV Eindhoven (first leg 11 February, second leg 19 February)

Manchester City v Real Madrid (first leg 11 February, second leg 19 February)

Sporting v Borussia Dortmund (first leg 11 February, second leg 19 February)

Club Brugge v Atalanta (first leg 12 February, second leg 18 February)

Celtic v Bayern Munich (first leg 12 February, second leg 18 February)

Feyenoord v AC Milan (first leg 12 February, second leg 18 February)

Monaco v Benfica (first leg 12 February, second leg 18 February)

Who fit meet for di last 16?

Liverpool and Barcelona no fit meet until di final afta dem finish for di top two of di league phase.

Di Reds go play one of Monaco, Brest, PSG or Benfica for di last 16 - while Barca go face anoda of those teams.

Arsenal, wey finish third, go play Feyenoord, Juventus, AC Milan or PSV.

Aston Villa, wey just finish for di top eight afta dem beat Celtic, go take on Sporting, Club Brugge, Atalanta or Borussia Dortmund.

Those ties go take place on 4-5 and 11-12 March.

But dem no go know which team exactly until di last-16 draw take place on 21 February.

Clubs go know dia potential route to di final by then - di draws for di quarters and semis go also take place dat day.

Which British clubs fit meet for front?

E dey possible say Liverpool and Aston Villa fit meet for di quarter-finals if dem both win dia last-16 ties.

Arsenal fit meet Celtic or Manchester City for dat round too.

But all of those potential fixtures depend on which way di last-16 draw go go. E also dey possible say British teams fit meet for di semis or final.

Eviritin go dey clear afta 21 February wen di draws for di last 16 onwards go happun.