Wetin we know about Israel attacks on Iran nuclear sites and military commanders

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Lana Lam
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
Israel don launch strikes across Iran on Friday, and tok say dem dey target di "heart" of Iran nuclear programme.
Wit counter-attacks expected "in di immediate future", Israel don declare state of emergency.
Dem kill Hossein Salami, chief of Iran Islamic Revolutionary Guards - wey be powerful branch of kontri armed forces, Iranian state media report, as well as nuclear scientists.
Di US say dem no dey involved for di strikes, wey also hit Iran main nuclear enrichment facility.
Dis no be di first time wey Israel go dey attack Iran facilitirs. For October 2024, Israel Defense Forces (IDF) say Israeli aircraft strike military facilities including air defence batteries and missile manufacturing facilities wey dem dey use to produce weapons.
Wen and wia di strikes happun?
Explosions bin dey reported for Iran capital Tehran around 03:30 local time (0100 BST).
Iranian state media say residential areas bin dey hit wit blasts wey dem also hear for north-east of Tehran. Di BBC no dey able to independently verify dis reports.
For Israel, na air raid sirens wake residents around di same time and receive emergency phone alerts.
End of Di one wey oda users dey read well well
Hours after di initial strikes, one explosion bin dey reported for di Natanz nuclear facility, according to Iranian state media, wey dey located about 225km (140 miles) south of di capital.

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin Israel don tok?
Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu say di strikes - called Operation Rising Lion - na "targeted military operation to roll back di Iranian threat to Israel veri survival".
E say di operation go "continue for as many days as e take to remove di spread".
"In recent months, Iran don take steps wey dem neva take bifor, steps to weaponise dis enriched uranium.
"If not stopped, Iran fit produce nuclear weapon in a veri short time. E fit be one year. E fit be within few months, less dan one year. Dis na clear and present danger to Israel veri survival."
For im address, Netanyahu also tank US President Donald Trump for "confronting Israel nuclear weapons programme".
One Israeli military official tell di BBC say Iran don get enough nuclear material to create nuclear bombs "within days".

Wetin Iran don tok?
One tok-tok pesin for Iran armed forces say di US and Israel go pay "heavy price" for di strikes, according to Reuters.
"Di armed forces go certainly respond to dis Zionist attack," Iranian tok-tok pesin Abolfazl Shekarchi, yarn.
Wetin US don tok?
US Secretary of State Marco Rubio say dem no dey involved for di strikes and no provide any assistance.
E say di top priority for di US na to protect American forces for di region.
Trump neva comment on di strikes.
For oda international reaction, Australia Foreign Minister Penny Wong say dem dey "alarmed by di escalation" and say di strikes risk "further destabilising region wey already dey volatile".
Wetin be Iran nuclear programme?
Iran don maintain say dia nuclear programme na for civilian purposes only. Dem get several facilities around Iran, at least some of dem don dey under attack by Israeli strikes.
But many kontris - as well as di global nuclear watchdog, di International Atomic Energy Agency (IAEA) - no dey convinced say Iran programme na for civilian purposes alone.
Dis week, di watchdog board of govnors formally declare Iran in breach of dia non-proliferation obligations for di first time in 20 years.
Dem cite Iran "many failures" to provide full answers about undeclared nuclear material and Iran stockpile of enriched uranium.
One earlier IAEA report say Iran get enriched uranium to 60% purity, enough near weapons grade uranium to make nine nuclear bombs.














