Air India plane wey dey head to London crash wit over 200 pipo onboard

Wetin we call dis Video, Footage shows moments before Air India crash
Read am in 3 mins

Rescue operation dey go on for di spot very near di airport wia one Air India plane crash.

Di plane wey dey head to London crash small time afta e take-off for Ahmedabad, western India.

One senior police officer for Ahmedabad tell ANI news agency say di London-bound plane crash inside one doctors hostel, wey be accommodation for local medical professionals.

E say police, firefighters and oda civic workers reach di spot within minutes. Rescue operations still dey go on.

Ambulances dey all over di area. Roads dey blocked.

Emergency response teams dey try to quench di fire.

Officials don confam say na 242 passengers and 12 crew members na im dey onboard di Air India plane wey crash.

Faiz Ahmed Kidwai, chief of India directorate of civil aviation, tell di Associated Press say di plane crash inside one residential area called Meghani Nagar.

One spokesperson from Sardar Vallabhbhai Patel International Airport for Ahmedabad say di airport no currently dey operational. All flight operations don dey suspended until further notice.

Air India tok say: "Flight AI171, wey dey operate Ahmedabad-London Gatwick, dey involved in one incident today".

Scene of di crash

Wia dis foto come from, AP

India aviation minister say "we dey on highest alert", as "rescue teams don dey mobilised".

Flight Radar say di Air India flight bin dey scheduled to fly from Ahmedabad International Airport to London Gatwick Airport at 09:50 local time. Im scheduled arrival time na 18:25 local time.

Di signal bin dey lost at 10:08 local time at 625 feet, less dan a minute after e take off, di flight tracking website tok for X.

Di plane history show say e dey regularly fly between India and destinations including Paris, Frankfurt, Tokyo, Amsterdam, and Melbourne.

Graphic show location of crash

Wetin we know so far

Air India aircraft

Wia dis foto come from, Getty Images

  • Di passenger plane bin dey head to London wen e crash shortly after take-off for Ahmedabad, western India
  • 242 pipo bin dey on board, including two pilots and 10 cabin crew
  • Of di passengers, na 169 Indian nationals, 53 British nationals, one Canadian national and seven Portuguese nationals dey
  • Di plane appear crash inside a residential area
  • Signal lost seconds after take-off wen di plane don reach 625 feet, according to Flight Radar
  • India aviation minister say rescue teams don dey mobilised
  • Di plane - wey be Boeing 787-8 Dreamliner - give mayday call to air traffic control after take off, but den no give anoda response