Gunman shoot popular Kenya senior lawyer to death

Wia dis foto come from, Law Society Kenya
Di killing Mathew Kyalo Mbobu by gunman wey drive ontop motorcycle for Nairobi dey shock Kenyans.
Di gunman shoot di lawyer for di busy street of di kontri capital afta e pull out gun and fire Mbobu.
Kyalo Mbobu wey be respected lawyer and former head of political parties dispute tribunal, bin dey drive home for Tuesday evening wen di gunman show up for motorcycle stay beside im vehicle and shoot am.
Witnesses wey dey di Lang'ata/Magadi road report say dem hear multiple gunshots.
Mbobu na former Chairperson of di Political Parties Dispute Tribunal for Kenya and well respected legal practitioner for di kontri.
Di Law Society of Kenya don describe di killing say e dey hateful and say dem gatz "deal" wit di crime quickly.
LSK express dia concern ova threats wey lawyers dey face say di killing get "all markings of predetermined assassination".
"Too often, advocates dey victimised and targeted for di work dem dey do," LSK president Faith Odhiambo tok for statement.
A gruesome video shared online shows a car's shattered window with the bloodied, lifeless body of the lawyer slouched over the steering wheel.
According to di police dem say di window of di car bin scatta sake of di gunshot, and dem recova di phone of di deceased.
From videos wey go viral for social media, we see how dem shoot di lawyer wit im white clothe, blood stain am and im head hang for di steering.
Several Kenyans dey link dis shooting to di one wey happun for April 2025, wia dem shoot Charles Ong'ondo Were, member of parliament for Kenya, for similar circumstances for busy road for di capital for suspected assassination.
Police dat time say several suspects dey arrested afta wetin dem see as "targeted and predetermined" assassination.
Dem bin charge some of di suspects since den.
Howeva, di motive for di attack of dis lawyer wey be like di shocking killing of dat lawmaker earlier dis year, dey unknown.
Investigations still dey go on.
Kenyans in shock as dey mourn lawyer Mbobu
Senate Speaker Amason Kingi say dis "cold-blooded killing" of Mbobu don "leave us all devastated and for deep shock".
"We expect di police to carry out speedy and serious investigation to find di reason and culprits wey dey behind dis wicked crime and ensure say justice dey served," e say.
Meanwhile, Faith Odhiambo wey be di President of di Law Society of Kenya say di late lawyer na fine teacher of di law.
"Kyalo Mbobu na fine practitioner and excellent teacher of law. Di bad crime wey claim im life gatz dey deal wit sharply."
Also Esther Muthoni Passaris wey be Nairobi County Member of di National Assembly, she say di killing of lawyer Mbobu dey senseless.
She say di death of lawyer Mbobu pain am
"Im brutal murder na grave crime to justice and dem gatz condemn am for di strongest terms. I dey urge di relevant authorities to begin investigations and ensure say di pipo wey do am face di law," she tok for her X post.
Di former Speaker of The Senate for Kenya Oga Amason Jeffah Kingi, say lawyer Mbobu na beta advocate for Kenya and e dey serve well.
Jeffah wey serve from 2013 to 2022, say im death na sad one for di kontri sake of say na dedicated public servant.
"Di cold-blooded killing of lawyer Mathew Kyalo Mbobu dis evening, as e dey drive home from work, don leave us all devastated and in deep shock."
"I be one of im students for University Nairobi, wia we benefit from im intellectual mentorship."
Di former Speaker call on di police to carry out speedy and serious investigation to get to di root of di mata and find di suspect wey carry out dat kain act.
E further send condolence give di family of di late lawyer and di legal group for Kenya.
For Edwin Sifuna wey be Senator for Nairobi County and di Deputy Minority Whip for Kenya Senate, di death of lawyer Mbobu dey painful becos na im mentor am and oda young pipo.
"Di circumstances of im death dey heartbreaking, painful and e dey worry especially sake of recent similar situations".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2










