Why Biden dey pardon thousands of pipo over di possession of igbo

Wia dis foto come from, Getty Images
America President Joe Biden don pardon all Americans wey dem bin find guilty for di national level say dem carry small amounts of marijuana - igbo.
Officials tok say na about 6,500 pipo wey get federal conviction for simple possession of marijuana go benefit.
No pesin currently dey federal prison for just possession of marijuana, na state level get most of di convictions.
But according to oga Biden, di federal pardons go make am easier for pipo to get employment, housing and education.
Wen e bin dey campaign, oga Biden bi promise to decriminalize cannabis use and delete im conviction.
Oga Biden bin tok on Thursday say "sending pipo go prison because dem get marijuana don scata too many lives and put pipo for prison for sometin wey plenti states no longer ban".
E add say na non-white pipo dey more likely pass to go jail for cannabis.
Mr Biden bin call out di 1994 crime bill wey make di penalties tougher for drug crime and make dem arrest and imprison pikin dem.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Democratic president say e wan ask all state govnors make dem do dia marijuana pardons.
E also direct di Department of Justice and Department of Health to review di classification of marijuana under federal law.
Mr Biden say e no make sense say marijuana dey classified for di same level as heroine and worse dan fentanyl.
Already for America, recreational use of marijuana dey legal for 19 states and Washington DC. Medical use dey legal for 37 states and three US territories.
But di drug still dey illegal for federal level. Dis one mean say even for states wia you fit legally buy and use weed, situation dey wey dem go fit gbab pesin.
Dis pardon dey come one month before di November congressional mid term elections. Di elections go determine di power balance for Washington for di last two years of oga Biden term.












