Nupeng strike: Wetin dey cause kwanta between Nupeng and Dangote refinery

Wia dis foto come from, NurPhoto via Getty Images)
Di Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers [Nupeng] don start di strike wey dem announce say go happun.
Di strike start on Monday morning as some members of di union don already stop work.
Nigeria goment bin try to intervene for di mata between Nupeng and Dangote refinery, but di union insist say di industrial action go still hold.
Na on Friday di union bin announce say dem go start industrial action on September 8, 2025.
As dem don start di strike on Monday, pipo dey hope say di meeting between Nupeng, Dangote Refinery and Nigeria goment go get head so dat di strike no go kontinu.
If goment no fit settle dem e go begin affect Nigerian in di coming days sake of say fuel fit begin scarce.
Wetin dey cause gbas gbos between Nupeng and Dangote Refinery?
Nupeng dey para say Dangote Petroleum Refinery plan to import 4,000 trucks wey dey use Compressed Natural Gas [CNG] wey di company wan use distribute petroleum products to retailers go cause kasala for di truck drivers department of di union.
For statement wey di union post on Friday, di union sama accuse on Dangote refinery say dem dey do activities wey dey against labour sake of say Dangote refinery don match leg for ground say di new drivers wey go drive di imported trucks no go join any union.
"Indeed by di virtue of Section 254C (2) of di Constitution of Nigeria, a ratified ILO provision na constitutional provision. Diafore any practice or policy by any employer wey wan deprive workers of dia right of association na affront to di constitution".
Nupeng also call NLC, TUC. and oda trade unions to join dem for dis struggle.
Dem dey also para say dis 4,000 trucks wey Dangote wan bring na threat to di work of dia members for di Petroleum Tanker Drivers branch.
Nupeng also tok say dem bin don do tok-tok and hold many meetings, wit di Nigerian Association of Road Transport Owners, to try convince Dangote to reconsider di decision but dem allegedly no gree listen.
"Di mata reach di climax wen MRS oil firm, wey Dangote's cousin, Sayyu Dantata get reportedly start di recruitment of drivers for di CNG truck and compel dem to sign undertakings say dem no go belong to any oil and gas union."
Even though di scheme wey suppose start on August 15, neva start sake of delay and logostucs mata for China, di refinery say dem go start wit some good number of trucks wen dem land Nigeria.
Wetin Nigeria goment dey do to solve dis mata?
Nigeria goment no fold dia hands at all, dem don chook mouth for di mata to try solve di problem.
Minister of Labour and Employment, Muhammad Dingyadi, bin announce on Sunday say im don summon all parties to showface for di reconciliation meeting for Abuja.
Di meeting na to chook eye to settle di tin wey dey cause kwanta between di union and di company wey be di policies wey Dangote refinery don make.
For statement wey di Head of Information and Public Relations, Patience Onuobia, Dingyadi sign, di ministry beg Nupeng to suspend di planned strike wey go shutdown petroleum operations.
Di ministry also beg di Nigeria Labour Congress to withdraw di support and backing wey dem dey give di union.
Di union, Dangote and goment go hold anoda meeting on Monday afternoon to know weda di strike go stop or dem go kontinu.
Oil workers strike for Nigeria
Anytime wey oil workers strike for Nigeria na goment dem dey fight wit sake of bad infrastructures like road and dia welfare.
But dis time own dey different and na goment det try to settle dem. If di strike kontinue Nigerians go begin feel di impact in days to come.
Many of dis type of strikes don happun in di past and e dey lead to fuel scarcity wit high cost of di product for black market.
Many unions including di Nigeria Labour Congress dey support dis Industrial actiom wey Nupeng dey do.









