Nigeria wan resume oil exploration for Ogoni, but Tinubu tell di leaders to go settle first

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria President Bola Tinubu direct di National Security Adviser (NSA), Nuhu Ribadu, to coordinate negotiations wit di parties wey dey within Ogoniland.
Dis na sake of say e dey try to resume oil production for di Niger Delta area wey get plenti oil.
President Tinubu call for "reconciliation, wia e beg di Ogoni pipo to work togeda make dem achieve peace, development di area, and get environment wey dey clean".
Oga Tinubu give di order for Abuja wen im receive Ogoni leaders and Rivers State Govnor, Siminalayi Fubara for Aso Villa, on Tuesday.
E say im administration go make peace, justice, and sustainable development for di area dia main focus.
Former Rivers State Govnor and Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, also attend di meeting.
Tinubu wey dey beg dem for unity and reconciliation, tell Ogoni pipo to set aside historical grievances.
Im add say make dem work togeda to achieve peace, development, and a clean environment.
For statement wey presidential tok-tok pesin bring out, President Bola Tinubu say, "We no go fit rewrite history in any way, but we fit correct some anomalies (wrong tins) wey happun for di past going forward. We no go fit heal di wounds if we kontinu to dey vex,"
President Tinubu ask ministers, di Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Limited, and di Rivers State Goment to cooperate wit di Office of di National Security Adviser (ONSA) to achieve dis mandate.
"Na great honour for me to hold dis meeting wit una, and na opportunity to dialogue wit di pipo of Ogoniland.
"E don turn many years since your children and myself collabo to resist military dictatorship for dis kontri. No body bin dream say I go dey for dis chair as President, but we thank God.
Wetin bin happun for Ogoniland
Ogoni mata still dey fresh for di memory of many pipo wey sabi how drinking water, plants and farm lands plus rivers bin sawa for Ogoni land inside Niger Delta sake of crude oil pollution since 1958.
Na since 1993 dem bin stop di exploration (drilling) of oil for Ogoni and even some activists do jail ontop di mata while some chop death by hanging sake of say dem dey demand cleanup of di area.
Some concerned civil organisations dey ask make Nigerian goment allocate one trillion dollar for di cleanup of di Niger Delta and compensation for lost livelihoods.
Di group also demand oda tins from di goment bifor crude oil production go fit resume for Ogoniland.
For statement wey di groups make available to BBC News Pidgin, dem say dis administration suppose call for stakeholder meeting for Ogoni land so dem go fit listen to di problem of di pipo and agree on how dem go fit tackle poverty wey di loss of livelihood wey di pollution bin cause.
"Di livelihoods and health of di Ogoni pipo don suffer immeasurably (well-well), wit no substantial accountability from di oil industry or adequate redress from di goment."
Dem warn say resuming oil production without addressing past injustices go only deepen mistrust between di goment, oil companies, and local communities.
Oda demands wey di groups make include:
1. Di immediate and transparent implementation of di UNEP report.
2. Accountability from oil companies, particularly Shell, for environmental damages and human rights violations.
3. Recognition of Ken Saro-Wiwa as an environmental hero.
4. Transition to renewable energy to reduce environmental harm.
5. Di groups also demand di need to end military intimidation in di Niger Delta
6. Ensure say all decisions involving Ogoniland respect di principle of Free, Prior, and Informed Consent (FPIC).
7. Dat make dem no drill one more oil well for di Niger Delta and di govment, and di oil companies gatz begin immediate and total cleanup of di region.
Who dey di meeting?
Chief of staff to di President Femi Gbajabiamila, NSA Nuhu Ribadu, Group CEO of NNPCL Mele Kyari, Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris wit oda ministers and aides.
Odas na Senators Barry Mpigi, Lee Maeba, Magnus Abe and Olaka Nwogu as well as Victor Giadom, Kenneth Kobani, Monsignor Pius Kii, Leedom Mitee, Bennett Birabi, Legborsi Pyagbara, Joe Poroma among odas.










