Naira Marley, PrimeBoy no get hand for Mohbad death - Court

Mohbad and others wey bin dey involved for im case

Wia dis foto come from, COLLAGE FROM INSTAGRAM

Wetin we call dis foto, Face of Mohbad wit pipo wey bin dey involved for im case
Read am in 4 mins

By Gift Andrew

Magistrate Court for Yaba Lagos don free Abdulazeez Fashola A.K.A Naira Marley and Samson Balogun Eletu A.K.A Sam Larry wey be music promoter say dia hand no dey for di death of rising music star Aloba Oladimeji lleriOluwa A.K.A Mohbad.

Di court also free Owodunni Ibrahim A.K.A. Primeboy and Mohbad's former Manager Opere Babatunde.

But di court tok say dem go go ahead to prosecute di nurse wey treat Mohbad wen e dey sick Feyisayo Ogedengbe and anoda of Mohbad friends Ayobami Sadiq ontop offence of Reckless and Negligent Acts wey dey contrary to Section 251 (e) of di Criminal Law, Ch C.17, Vol.3, Laws of Lagos State, 2015.

Magistrate Ejiro Kubenje make di decision on Tuesday based on advice from di Department of Public Prosecution DPP wey tok say di four of di accused no get case to answer for di matter.

Di DPP advice wey BBC pidgin see tok say even though dem get documented accounts wey show say Naira Marley and Sam Larry carry out unlawful assault on Mohbad, but di accusations no mean say two of dem dey criminally responsible for di death of di singer.

Di advice explain how Mohbad take contact illness wey lead to im death.

How Mohbad take get injury wey lead to im death

Di DPP advice read say for September 2023, Mohbad and im friend Adeyemo Boluwatife A.K.A. Darosha plus im wife Wunmi and PrimeBoy plus dia driver Fidelis Esandor and others follow go one concert for wey Soso Sobrekon organize for Ikorodu.

Wen dem wan leave, PrimeBoy try to stop Mohbad from leaving sake of some touts wey dey di area.

Na dis matter annoy Mohbad wey make am throw blows on PrimeBoy, but di guy no return di blows.

'Na as im dey punch PrimeBoy im hit glass of di car and cut him right hand and get injury. Di injury swell up and due to poor management by di auxiliary nurse wey no get proper medical training, e lead to im death' na so di document read.

Mohbad

Wia dis foto come from, Mohbad Instagram

Wetin we call dis foto, Mohbad

Di advice from Department of Public Prosecution DPP dey six pages. Na di director of DPP for Lagos Mr Martin Babajide sign am on behalf of di state attorney general Mr Lawal Pedro.

Di document read say, "we no fit wait indefinitely for di coroner report before we go issue legal advice". Remember say di case about death of Mohbad don dey dormant for a while as dem dey wait for di coroner report.

Early February, Mohbad papa Joseph Aloba to BBC, dey request make goment resume di case and conclude am so dem fit go bury di late singer.

Di DPP advice dey based on di conclusion of forensic investigation wey di state do. Tori be say Mohbad family also opt to do dia own forensic report.

Di document detail how Mohbad sign up to Naira Marley record label for 2019, wen im no too dey comfortable again wit di label, e decide to change di label and change manager too for 2022.

"Di decision to leave no go down well wit Naira Marley. Na dis issue lead to di accusations of bullying, assault and harassment on Mohbad and some of im friends" na so di document read.

DPP advice also indict Mohbad friend Ayobami Sadiq wey bring di auxiliary nurse Feyisayo Ogedengbe wey come treat Mohbad knowing say she no get training from a medical practitioner. Dis act di DPP say constitute an offense of involuntary manslaughter.

Di document read say "Ogedengbe arrive for di deceased house and give am injection and oda medications without asking for im medical history. After di injection, di deceased vomit twice and fall down, begin convulse".

Emergency help wey dem offer am no help di matter, na so doctors declare am "brought in dead (B.I.D.) for Med Care Hospital, Lekki, Lagos.

Section 16(1)(d) of di Criminal law, 2015 provide say wia dem commit offence, any pesin wey bring in di pesin wey comot di offence also dey guilty of same offence.

"Sadiq having procured Ogedengbe, an unqualified nurse, to treat di deceased, thereby leading to im death, Sadiq dey culpable of same offence as Ogedengbe" na so di document read.