You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Buhari commit impeachable offence sake of old naira notes' - Lawyer
Ogbonge Nigerian lawyer Ayo Ademuliyi tok say 10 Nigerian State govnors wey approach di Supreme Court to ask say make dem aside President Muhammadu Buhari pronouncement no do anytin wrong.
Lagos, Kaduna, Kogi, Zamfara, Ondo, Ekiti, Katsina, Ogun, Cross River and Sokoto States govnors say Buhari directive wey extend di validity of di old 200 naira notes for 60 days and ban old 500 and 1000 naira notes dey unconstitutional.
Di states through dia Attorneys General say “Buhari dey give imsef judicial power of di Supreme Court” sake of say di case still dey for court.
Di counsel for di applicants cite Section 232(1), Section 6(6)(b) and Section 287(1) of the 1999 Constitution as amended, wey include di protection of di Supreme Court’s dignity and wey ensure compliance wit im orders by all pesins and authorities.
Ademiluyi tell BBC Pidgin say wetin President Buhari do na impeachable offence and add say Nigerian lawmakers owe di kontri pipo historical duty to impeach am according to di provisions of di constitution.
Ademiluyi say even as dis state govnors and some odas don tell dia pipo to continue to spend di old naira notes, dem neva commit any offence sake of say dem dey obey di Supreme Court injunction on di mata, wey say make di old naira notes still dey function as legal tenders till dem hear di case.
"Di pronouncement of di state govnors no dey against di law, e no be treason. In fact, dem dey respect di Supreme Court of di land, unlike wetin Mr President do," di lawyer tok.
'Dem no advise Buhari well'
Di tok-tok pesin for di All Progressives Congress Presidential Campaign Council, Festus Keyamo, say President Buhari get good intentions sake of di naira redesign policy but di pesin wey advise am no advise am well.
End of Di one wey oda users dey read well well
Keyamo wey be Senior Advocate of Nigeria yarn dis one for Channels Television’s ‘The 2023 Verdict’ a day afta di President announce say im don direct di CBN to allow di old 200 naira notes circulate for 60 days.
E say if na im advise di President, e go tell am say make e comply wit di Supreme Court order, wey say make all di old notes still dey circulate.
“My view be say di President act honestly, witout intention to slight di Supreme Court, but im fit don act on wrong advice. No be me give dat advice, no be my responsibility. I no know who give dat advice.
Di lawyer tok say all authorities for Nigeria gazz obey di orders of di Supreme Court.
“Anytin to di contrary na descent to anarchy, and I fit tell you, di day we begin to disobey di order of di Supreme Court, dat na invitation to intervention in our democracy, Keyamo tok.
How di naira controversy take start
Di Central Bank of Nigeria (CBN) bin implement dia naira redesign policy wey direct pipo to stop to dey use old N200, N500 and N1,000 notes and embrace di new ones.
Sake of complaints from Nigerians, di CBN bin extend di deadline wey go make di old 200, 500 and 1000 naira notes invalid from 31 January to 10 February .
However, di Supreme Court say make di Federal Goment, di CBN, and di commercial banks suspend di deadline till wen dem go hear di suit wey three state govnors - Kaduna, Kogi and Zamfara bin file to challenge di policy.
Di Supreme Court on 15 February adjourn di hearing of di suit to 22 February.
On 16 February, President Muhammadu Buhari address Nigerians and say im don direct di CBN to release di old notes of 200 for Nigerians to continue use am as legal tender.
Di President tok say di 200 go function as legal tender alongside new 200, 500 and 1000 naira notes.
''To further ease di supply pressures particularly to our citizens, I don give approval to di CBN say make dem release di old N200 bank notes back into circulation and dat make dem allow am circulate as legal tender with di new N200, N500, and N1000 banknotes for 60 days from February 10, 2023 to April 10 2023 wen di old N200 notes cease to be legal tender,'' Buhari tok.
E say di old notes go continue to be legal tender from February 10 till April 10 2023.
Dis mean say di old 500 and 1,000 naira no longer dey valid as legal tenders.
Kataka wey di policy cause
Di policy cause kata-kata for many parts of di kontri as some banks dey hide di new naira notes and customers no see both new and old naira notes collect for counter and ATMs. Dis one make some angry customers attack banks and stage protests for some parts of di kontri.
For Warri, Delta State, one video show wia bank customers dey climb step escape sake of say angry customers wey no see cash collect begin attack di bank staff. Oda videos show some bank customers dey naked diasef to protest sake of say dem no see moni collect for bank.
Oda videos show ATMs wey angry customers destroy for Abeokuta, Ogun state sake of dia lack of access to cash. Some banks don shut down to guarantee dia staff safety while some dey close early and also take oda preventive measures against kasala.
Also for Ibadan, di southwest part of di kontri, kasala burst for Apete area of of di town as residents waka enta street to protest di naira swap policy of di CBN.
Lagos, Oyo, Kwara and Edo States no carri last for di crisis wey di naira policy cause as angry Nigerians wey dey live for di states begin attack banks and ATMs to unleash dia anger sake of di naira scarcity wey di policy cause.