Caf awards 2024: All you need sabi about am

Collage of Caf Best Player of di Year Men's finalists

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Collage of Caf Best Player of di Year Men's finalists
Read am in 6 mins

Di Confederation of African Football (Caf) awards for 2024 go happun on Monday 16 December.

E go happun for Marrakech, Morocco as Caf don ready to crown di best players from Africa for 15 categories.

Di awards na to showcase and recognise players and pipo wey dey outstanding for African football.

E dey also celebrate di best talent for African football, wey dey honour players, coaches and teams, both male and female, in different categories.

Football fans around di world dey wait for dis exciting moment to see which players go win di award s and who go be di best Men and Women's Footballer of di year for 2024.

Di Confederation of African Football don dey organise dis event since 1992.

Which kontri go break di Caf awards 2023 domination by Nigeria - Asisat Oshoala and Victor Osimhen record? or we go see a repeat of two Nigerians again of Ademola Lookman and Chiamaka Nnadozie win am?

Time and how to watch am

Pipo wey wan see how dem go unveil di winner of di 2024 Caf Awards for Marrakech on Monday fit watch am around 19h00 local time wey be (18h00 GMT/ 20h00 Cairo time/ 21h00 East African time).

You fit watch am Sports TV stations wey dey partner wit Caf or stream am online for Caf website as dem dey do evri year.

Who be di five finalists and Profile

Na five nominees dey go head to head for who go be di Africa Men's Best Player.

Di battle na between Cote d'Ivoire and Brighton & Hove Albion winger Simon Adingra.

Borussia Dortmund and Guinea international striker Serhou Guirassy and Morocco right-back Achraf Hakimi, who dey play for Paris Saint-Germain.

Odas na Atalanta winger and Nigeria forward Ademola Lookman while Mamelodi Sundowns goalkeeper Ronwen Williams dey hope say im performance for di Africa Cup of Nations Cote d'Ivoire 2023 go help am win di award.

Simon Adingra

Foto of Simon Adingra of Cote d'Ivoire

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Simon Adingra of Ivory Coast celebrate against Nigeria during di Africa Cup of Nations final match between Nigeria and Ivory Coast.

Adingra na winger wey be important figure for Cote d'Ivoire for di 2023 Africa Cup of Nations wey happun for February 2024.

Im bin score di 90th minute equaliser for an extra-time wey give dem victory against Mali for di quarter-finals.

Im also provide two assists for di final against Nigeria as di Elephants bin struggle to put dia difficult start behind to campaign to lift di trophy.

Dem bin give am di Best Young Player for di tournament.

Simon Adingra wey dey 22 years also be ogbonge player for Brighton & Hove Albion for di Premier League dis year.

Serhou Guirassy (Guinea)

Foto of Serhou Guirassy of Guinea

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Serhou Guirassy of Guinea

Guirassy shine well-well as im score 30 goals for many games for di German Bundesliga wit Stuttgart for di 2023-24 season.

And im carry di same hot form enta Borussia Dortmund for di new season.

Im tally of 28 Bundesliga goals dis season beat previous record for Stuttgart wey be 25, set by Mario Gómez for 2008-09.

Only Bayern Munich forward Harry Kane score more goals pass Guirassy for di year.

Di 28-year-old bin score 23 goals for club and kontri for di season under review (January-October 2024), including one hat-trick for Guinea against Ethiopia for di Africa Cup of Nations Morocco 2025 qualifiers, and two more a week later against di same opponents.

Achraf Hakimi (Morocco)

Foto of Achraf Hakimi

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Achraf Hakimi for di 2024 Olympics for Paris, France

Hakimi na one of di most consistent right-backs in European football for a long time.

Im also get an excellent year for Paris Saint-Germain, as im help dem finish win dia third French Ligue 1 title back to back last season.

PSG bin get 'Double' victory for di Coupe de France final over Lyon for May, while Hakimi also help Morocco win bronze medal for di Paris Olympic Games.

Wit im quality and leadership, im still important figure for di Morocco national team.

Im don play 14 internationals for 2024, and im score against di Democratic Republic of Congo for di Africa Cup of Nations, Cote d'Ivoire 2023.

Ademola Lookman (Nigeria)

Foto of Ademola Lookman

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ademola Lookman during di Africa Cup of Nations final football match between Ivory Coast and Nigeria

Lookman dey hot well-well dis period as im dey for im best form dis 2024. Im help turn im Italian Serie A club Atalanta into title contenders and help dem win di UEFA Europa League trophy.

Dis na dia first major trophy for di club for 61 years.

Lookman wey be 27-year-old bin score hat-trick for di final as Atalanta becom di only team for di 2023-24 campaign to beat German Bundesliga outfit Bayer Leverkuse.

Lookman play one of di finest football as im provide one of di great final displays for European football history.

Lookman also help Nigeria reach di final of di Africa Cup of Nations, Cote d'Ivoire 2023, wia dem lose to di hosts.

Im play beta football, score three goals, and dem also name for di Team of di Tournament. Ballon d’Or nominee Lookman dey hunt for greatness

Ronwen Williams (South Africa)

Foto of Ronwen Williams of South Africa

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ronwen Hayden Williams of South Africa wit im awards for di 2023 Africa Cup of Nations

South African Goalkeeper Williams catch pipo eyes afta e save penalty for di Africa Cup of Nations Cote d'Ivoire 2023.

Dis memory go dey pipo ind as im also captain South Africa to win bronze medal.

Dem beat Morocco for di round of 16, before Williams' shoot-out heroics make dem baet Cape Verde and DR Congo.

Im also help Bafana Bafana qualify for di Africa Cup of Nations Cote d'Ivoire 2023 and dem nominate am for Fifa best goalkeeper in 2024.

Im dey 32 years and help im club Mamelodi Sundowns set a joint record low of 11 goals conceded in 30 games for di South African Premiership as dem lift di trophy a record-extending seventh domestic league title back to back.

Di last past five winners na:

2023: Victor Osimhen, Nigeria - Napoli (ITA)

2022: Sadio Mané, Senegal - Liverpool (ENG)

2021: Not awarded

2020: Not awarded

2019: Sadio Mané, Senegal - Liverpool (ENG)

2018: Mohamed Salah, Egypt - Liverpool (ENG)

2017: Mohamed Salah, Egypt - Liverpool (ENG)