Champions League knockouts prediction

Wia dis foto come from, Getty Images
Two games remain to complete di new league phase format of di Champions league.
Liverpool na di first team to guarantee dia place for either di round of 16 or knockout phase play-offs.
Di Reds book dia place for knockout phase sake of dia results on Matchday 5, wey see dem beat Real Madrid 2-0
Barcelona na di only team to join dem on Matchday 6, di Spanish team collect dia fifth win of di league phase by overcoming Dortmund 3-2.
36 teams dey play di league phase dis season, each side go play eight different teams - four at home and four away.
Opta Supercomputer don predict how di table go be.
According to dia prediction, dem give Liverpool 84.8% chance of finishing top of di Champions League standings afta di end of di league phase.
Teams wey finish for di top eight go qualify automatically for di last 16, while dose from ninth to 24th go compete for a two-legged knockout play-off for di chance to join dem.
End of Di one wey oda users dey read well well
Liverpool go lead di way into di last 16 - Opta
Oda key takeaways from di latest projections include:
- Second-placed Barcelona get just a 10.5% chance of overtaking Liverpool to top spot
- Arsenal get a 28.6% chance of finishing second, leapfrogging Barca, and a 21.1% likelihood say dem go remain for third
- Aston Villa face di most likely placings spread between seventh (10.4%), eighth (10.6%) and ninth (8.8%)
- Harry Kane Bayern Munich fit be di big movers ova di final two games - currently dem dey 10th but di likelihood say dem go finish as high as fourth na (14.4%)
- Projections show say Celtic wey dey (19th) and Manchester City wey dey (20th) go gada enough points to reach di knockout phase.
- Dem give di Scottish champions only a 3.9% chance of finishing 25th, while di Premier League title holders get 5.8% chance of ending for di first elimination spot.
- Di news no too good like dat for City fans, though. Dem give di Premier League champions 0% chance of making am to make di top eight.
NB: If City win dia final two games dem go finish on 14 points - projections show say teams go need 17 points or more to make di top eight and qualify directly for di last 16.
How teams go qualify from di league phase?

Wia dis foto come from, BBC Sport
Di top eight teams afta di eight games of di new extended league phase of di Champions League go enta straight through to di last 16.
Sides wey finish from ninth to 24th go progress to knockout football but face an extra two-legged play-off, wey dem go play on 11/12 February and 18/19 February.
Teams wey finish 25th or below go chop elimination from European competition.
Di league phase go resume on 21/22 January bifor di final round of matches on 29 January.
Which sides dey face danger of elimination?

Wia dis foto come from, BBC Sport
Sides wey finish from ninth to 24th go face extra round of di knockout phase, basically na two-leg 'play-off'.
Manchester City and Celtic currently dey among di group of teams, di question now na: if dem go stay dia?
Di sides wey finish 25th or below go comot from European competition. Dem no go fall enta Europa League, like previous seasons.
Opta predictions – For points wey go dey enough to qualify?
Dis graph show roughly how many points go dey needed to qualify for di knockout stages of di Champions League.
Di predictions dey make afta di fifth round of matches, but e offer a decent guide to di points tally teams go need afta eight matches to qualify.
Di black bars show di cut-off point to reach di play-off phase [ninth to 24th] go be 11 points, although 10 points suppose give teams more dan 90% chance.
For now, dat na di mark both Celtic and Manchester City go get for dia minds. So two draws or one win fit dey enough for Celtic, wey currently dey on nine points. City dey eight points, so one win from dia final two games suppose help dia case.
For dose teams wey dey hope to finish for di top eight and qualify directly through to di last 16, di yellow bars show say 16 points go give dem more dan 80% chance of achieving dia goal, 17 points go almost certainly see dem through.
So Arsenal and Aston Villa need four points from dia final two games to retain dia places for di top eight.
And den Liverpool – wit 18 points, Opta predictions show say dem already get enough to guarantee dia place for di last 16.

Wia dis foto come from, Opta
Where di British sides stand & who do dem go play next?
So now we know how Uefa go decide di Champions League knockout places and wen dem go play di remaining matches of di league.
Liverpool – Dey 1st wit 18 pts, dem get a three-point lead ova Barcelona wey dey second place
21 Jan - Lille (h)
29 Jan - PSV (a)
Arsenal - 3rd, dey level wit five oda teams on 13 pts but dem dey above dem on goal difference, wit just a one-point cushion ova ninth place
22 Jan - Dinamo Zagreb (h)
29 Jan - Girona (a)
Aston Villa - dey 5th place, also on 13 pts
21 Jan - Monaco (a)
29 Jan - Celtic (h)
Celtic – Dey 21st on 9 pts, two points above di elimination zone
22 Jan - Young Boys (h)
29 Jan - Aston Villa (a)
Man City – Dey 22nd on 8 pts, one point above Paris St-Germain for di elimination zone, wit a trip to Ligue 1 champions up next
22 Jan - Paris St-Germain (a)
29 Jan - Club Brugge (h)













