Latest Champions League results and table

Manchester City coach Pep Guardiola

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pep Guardiola of Man City
Read am in 4 mins

Manchester City collect 2 - 0 defeat from Juventus for dia Champions League fixture on Wednesday. Dis result drop dem to number 22 for di league table.

Di defeat ba dia seventh defeat in 10 games for all competitions season. Dem don get only one win and two draws from di ten matches.

Di English champions dey struggle for all competitions dis season and dia coach Pep Guardiola seem to dey under heavy pressure, but e tell tori pipo after Wednesday loss say "we are still di best, I love my team".

For di oda match, Bukayo Saka score two goals and do one assist as Arsenal beat Monaco 3 - 0. Dat win move Arsenal to number 3 of di new Champions League table.

Barcelona travel go Germany to beat Dortmund 3 - 2 to maintain a second position for di league table season.

For di oda Wednesday game, Atletico Madrid sama Slovan Bratislava 3 - 1 while AC Milan win Red Star Belgrade 2 - 1.

Lille beat Sturm Graz 3 - 2 while Feyenoord sama Spart Prague 4 - 2.

Di highest goal scoring team of di day na Stuttgart wey beat Young Boys 5 - 1, while di game between Benfica and Bologna end on a goalless draw.

Liverpool still dey top di table with 18 points. Any team wey fall below number 24 at di end of di table season go dey eliminated from di competition.

Tuesday Champions league results

Kylian Mbappe score goal

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kylian Mbappe

Kylian Mbappe score im 50th Champions League goal as Real Madrid cruise pass Atalanta for dia Tuesday night clash for di Gewiss Stadium Italy.

Di goal na im 12th goal in all competitions since e join di Spanish giants dis summer.

Di striker start im Champions league career at age 16 and achieve di 50 goals mark at age 25.

Vinicius Jr and Jude Bellingham score di oda two goals of di match for Madrid while Charles De Ketelaere and Ademola Lookman score one each to keep di score at 2 – 3.

Dat win carry Madrid from 24th position to di 18th position for di Champions League table, while Atalanta drop from di 5th position to di 9th position.

Oda results from di night show say Bayern Munich sama Shakhtar Donetsk 5 – 1 while Liverpool continue dia seemless run wit a 1 – 0 win over Girona.

Inter Milan suffer 1 – 0 defeat against Bayer Leverkusan while PSG beat RB Salzburg 3 – 0. Aston Villa travel go Germany to beat RB Leipzig 2 – 3 for dia domot.

Club Brugge at home beat Sporting CP 2 – 1 while Brest collect 1 – 0 win over PSV Eindhoven.

Di Champions League table so far

Di league table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Table
Di league table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, League table

Wen 2024/25 Champions League knockout phase go start

Knockout phase play-offs: 11/12 & 18/19 February 2025

Round of 16: 4/5 & 11/12 March 2025

Quarter-finals: 8/9 & 15/16 April 2025

Semi-finals: 29/30 April & 6/7 May 2025

Final: 31 May 2025

Wia dem go play Champions League final for 2025

Di 2024/25 Champions League season final go take place for di Allianz Arena, home of Bayern Munich.

Dis go be di first time since 2012 dem go play am dia.

Di 2024/25 winners also go gain a place for di league phase of di 2025/26 Uefa Champions League, if dem no qualify through dia domestic competition.

Di new format of di Uefa Champions League bin start on Tuesday, 17 September, 2024 and na very different format to wetin di UCL wey football lovers across di world bin dey used to.

Dis 2024/2025 season, instead of group stages, every team go play eight matches in a league format - four home and four away.

Afta dat, di first eight for di league table go qualify for round of 16 and position 9 t0 24 go enta play-off to determine who go also enta round of 16, while di odas don comot for di competition.