How security guard allegedly shoot and kill fan wey celebrate Arsenal win ova Manchester United

Wia dis foto come from, Farish Magembe
One security guard for Uganda allegedly shoot and kill one fan of English club Arsenal, wey bin dey celebrate di team victory ova Manchester United.
Anoda fan wunjure as di guard allegedly open fire for big crowd of happy supporters for one restaurant for Lukaya town for central Uganda, about 100km (62 miles) from di capital Kampala.
Dis incident bin happun towards di end of di match, wey Arsenal win 2-0.
One local journalist tell BBC say di building manager bin vex well-well sake of di noise wey di happy supporters bin dey make so im ask im guard to intervene.
But, di fans no reason im warning to quiet down, dem still continue to make noise .
Witnesses tell journalist, Farish Magembe, say di owner bin switch off di light for di restaurant, dat tin wey im do make di fans vex more, and dem respond by making more noise.
Na afta dat time wey di guard allegedly start to shoot, im shoot several times.
Di victim, dem identify am as 30-year-old John Ssenyonga, im die for di scene. Anoda long-term Arsenal fan, Lawrence Mugejera, dem carry am go hospital for treatment.
Both di guard and di manager of di building dey on di run afta di incident, di police dey look for dem.
Di regional police tok-tok pesin, Twaha Kasirye, tok for Daily Monitor newspaper say dem don recova gun for di scene.
"We condemn di incident and we dey ask anybody wit information to come help di police bring di suspect to book to speak up," e tok.
E also advise fans to control dia excitement.
Tensions and tragic violence from di outcome of football matches, especially between English clubs, dey common for dis kontri becos English Premier League dey popular hia well-well.
For October, one Arsenal fan stab one Manchester United fan afta di two of of dem argue ova di results of a clash between Arsenal and Liverpool.
for January last year, a youth councillor die from stab wounds for Kampala afta im go separate fight afta Arsenal lose to Manchester City.
Just a week bifor dat, one Arsenal fan dem beat am to death for Adjumani, for di West Nile district.










