Police identify 18-year old suspect for Canada school shooting wey kpai nine pipo, injure 25

Wia dis foto come from, Getty Images
Police don name one 18-year-old as di suspect for one shooting incident wey kpai eight pipo and injure plenty odas for British Columbia, Canada.
Dem also find di suspect, Jesse Van Rootselaar, as e don die from self-inflicted gunshot injury. E neva clear wetin be di motive for di attack.
Six pipo bin die and at least 25 odas get injury for Tumbler Ridge Secondary School. Dem find two oda pipo - di suspect mama and im step-brother as dem don die for one house wey dey near di school.
Authorities tok say Van Rootselaar na man wen dem born am but e dey identify now as woman.
"I fit tok say dem born Jesse as a biological male and approximately six years ago e start to transition to female," Dwayne McDonald, di deputy commissioner for di Royal Canadian Mounted Police (RCMP) tok.
Di shooting bin first start for di nearby home, den di suspect bin go to di school, McDonald tok.
Di victims for di school na 39-year-old female educator, three female students, all of dem dey 12 years old, and two male students, one dey 12 and di oda 13.
Authorities say dem no believe say any oda suspects dey involved for di shootings.
Police tok say dem bin don visit di suspect family home several times for di past years and some of di calls na wetin concern mental health issues.
Dem say dem know di suspect Van Rootselaar, and say dem bin don start di process of reaching out to di public health care system to understand di interactions wey fit don take place, according to wetin British Columbia Premier David Eby bin tell tori pipo outside di Tumbler Ridge town hall late on Wednesday evening.
Di suspect bin get valid gun licence wey don since expire, McDonald tok.
Police also say Van Rootselaar bin drop out of Tumbler Ridge Secondary School four years ago.
How di shooting bin hapun
Around 1:30 pm (20:30 GMT) on Tuesday, police bin receive report of say active shooter dey for Tumbler Ridge Secondary School.
Officers arrive for di scene witin two minutes of di call, dem hear active gunfire and enter di school, McDonald tok.
Within minutes dem locate di shooter, who don die deceased from wetin police say na self-inflicted gunshot wound.
Authorities also find two guns - one long gun and one modified handgun - for di scene. But McDonald say e neva dey clear di roles wey di two guns bin play for di shooting.
Police den start to search for victims truout di school. Dem take two victims to hospital using air ambulance and dem still dey for hospital.
Tumbler Ridge na remote area wit population of about 2400 pipo for western Canada.
Di Secondary School get about 160 students wey dey between 12 to 18 according to di school website, but authorities don shutdown di school for di rest of di week and dey give counseling to dose wey need am.
Canada Prime Minister Mark Carney say "I dey devastated by di shooting and govment dey stand wit di British Columbians as dem dey confront dis horrible tragedy".
Carney tok say di students and teachers bin witness one kain cruelty wey dey unheard of during di shooting, and some of di victims remain for hospital "dey fight for dia lives".
E cancel di waka wey e bin wan go to Munich Security Conference sake of di incident.
History of shooting for Canada
Di shooting na one of di deadliest shootings for history of Canada.
For 2020 gunman wey pose as police officer kill 22 pipo for Nova Scotia axis of di kontri.
For 1989 dem kill 14 women for one anti feminist attack for L'Ecole Polytechnque University for Montreal.










