Trump hint on anoda strike if 'killing of Christians' kontinu for Nigeria, as military deny arrival of US troops

Wia dis foto come from, Alex Wong/Getty Images
US President Donald Trump don chook mouth again ontop wetin e describe as violence against Christians for Nigeria
Trump say e know say Christians dey come under attack for Nigeria but im no go allow make dat kontinue.
E add say im go deal 'violently' wit di jaguda pipo wey dey carry out di attacks on Christians for Nigeria.
President Trump tok dis one wen e dey tok for di 74th National Prayer Breakfast, wia e also recognise di First Lady of Nigeria, Remi Tinubu.
"We dey honoured as di First Lady of Nigeria join us, wey happun to be a Christian pastor for di largest church and she be very respected woman," e tok.
Di National Prayer Breakfast na annual event wey evri US president dey attend since di time of Dwight D. Eisenhauer, and dis na di sixth time wey Trump go give remarks for di Prayer Breakfast.
During di remark for di National Prayer Breakfast, Trump tok on different issues wey concern insecurity around di world and how im administration dey fight to defeat jaguda pipo.
Trump say di US military under im administration bin 'knock out' Islamic States (ISIS) for Nigeria sake of how dem dey attack Christians.
Wen e dey give im remark, Trump say im bin dey defeat di ISIS wen e first enta office, but di ISIS bin come back during di four years wey im comot for office.
Trump say na di ISIS dey kpai Christians for Nigeria.
"Wen I no dey office for four years, ISIS rebuild again. We get a little bit ISIS again, but we knock di hell out of dem di oda day for Nigeria, because dem dey kill Christians."
Trump say di ISIS no fit dey kpai Christians and e go dey look, say im go attack dem back 'violently'.
"You know say dem dey kpai Christians (ISIS), you no fit do dat . Wen Christians come under attack, dem know say dem go come under attack violently by President Trump."
For December 2025, US President Trump say dem don launch a "powerful and deadly strike" against di Islamic State for Nigeria- few months afta e declare Nigeria as kontri of particular concern sake of how dem dey kpai 'thousands of Christians' for di kontri.
Trump say under im direction as Commander in Chief of di United States, e "launch a powerful and deadly strike against ISIS terrorist Scum for north west Nigeria, wey don dey target and viciously kill primarily, innocent Christians at levels wey dem never see for may years".
All of dis dey show up again as Nigeria Defense Minister, Christopher Musa bin confam to BBC say one small team of US troops dey operate for di kontri.
E say di US military go be "training team to prepare our troops for operations".
Di minister no give details about di size of di team, wen dem land, wia dem base, or how long dem go dey for Nigeria.
Di United States Africa Command (Africom) - wey dey responsible for military relations between di US and kontris and organizations for Africa - bin also say a "small team" of dia troops don enta Nigeria to help di Nigeria military wit dia ongoing fight against terrorists for di northern region of di kontri, according to Reuters.
Meanwhile, di Defence Headquarters for Nigeria say di presence or deployment of United States troops for Nigeria na sake of di partnership wey exist between di two kontris.
According to Samaila Uba wey be di Director of Defence Information, e say na di partnership between Nigeria and US bin lead to a "two-day high-level Working Group engagement" wey bring togeda senior U.S. govment officials and di Nigerian counterparts.
"Dis meeting follow earlier engagements for di United States reflecting mature, trust-based relationship focused on practical outcomes."
"All engagements dey conducted in full respect of Nigeria sovereignty and in accordance wit existing bilateral frameworks."
Nigeria say dia partnership wit di US na for "capacity building, professional military education, intelligence sharing, logistics support and strategic dialogue to address shared security concerns, including terrorism and transnational threats."










