Who be di Russian general wey dem shoot plenty times for Moscow

Wia dis foto come from, Russian Defence Ministry
- Author, Paul Kirby
- Role, Europe digital editor
- Read am in 3 mins
Dem don shoot one high-profile general for Russia military several times and e wunjure for Moscow. Im name na Lt Gen Vladimir Alexeyev.
Dem immediately carry Lt Gen Vladimir Alexeyev go hospital afta di attack for residential block of flats on di north-western outskirts of di Russian capital.
For now, im condition dey unknown.
Vladimir Alexeyev na number two man for di main directorate of Russia GRU military intelligence.
E be di latest high-ranking military figure wey dem target for di capital since di full-scale invasion of Ukraine begin almost four years ago.
Dem place am under European Union and UK sanctions afta di GRU chop accuse say dem dey behind di 2018 nerve agent attack for Salisbury for di UK.
"Di victim dey hospitalised for one of di city hospitals," Svetlana Petrenko of Russia Investigations Committee tok.
Dem say dem don open criminal case for attempted murder.
Di gunman run comot and investigators search CCTV footage for clues and begin to interview witnesses.
One neighbour of Alexeyev tell di Reuters news agency say she bin wake afta she hear di sound of "several" shots and later hear anoda neighbour dey scream for help.
"Dis na all I hear. Oda neighbours bin rush out, too. Dem ask how dem fit help, mak dem call ambulance and police, but she don already call dem."
Who be Lt Gen Vladimir Alexeyev
Lt Gen Vladimir Alexeyev don play major role during di war for Ukraine, wia e follow for tok wit Ukraine during di Russian siege of di city of Mariupol for 2022.
Dem also send am go negotiate wit di head of di Wagner mercenary group, Yevgeny Prigozhin, wey lead short and bloody mutiny for June 2023.
Im oga for GRU, Igor Kostyukov, don dey in charge of Russia negotiating team wey dey take part for security issues wit di US and Ukraine for Abu Dhabi.
Kremlin spokesman Dmitry Peskov say dem don brief President Vladimir Putin on di shooting.
"We wish first of all say di general bin survive and recova. We hope say dis go be di case," e tell reporters.
E neva dey clear who dey behind di shooting on Friday morning for residential block on Volokolamsk Highway for Moscow but Russian Foreign Minister Sergei Lavrov dey accuse Ukraine.
Kyiv neva comment ontop di incident as dem don claim some attacks on Russian military figures for di past.
Russian intelligence official bin claim say dem stop an attempted attack on a Russian soldier for St Petersburg for di end of last month.
One Uzbek man chop jail for January for di 2024 killing of anoda general, Igor Kirillov, for explosion wey happun outside block of flats for Moscow.
Ukraine SBU intelligence say dem dey behind di attack.
Lt Gen Kirillov dey in charge of Russia Nuclear, Biological and Chemical Protection troops.
For December 2025, anoda high-ranking officer for di GRU, Lt Gen Fanil Sarvarov, kpai wen explosive device detonated under car for Moscow.
Lt gen Sarvarov bin dey in charge of di armed force operational training department, according to Russia Investigative Committee.










