Ukraine maps wey track di war wit Russia

Foto wey show Ukraine map, e dey ontop foto of tank and soldier wey dey hold shoulder launcher
    • Author, By the Visual Journalism team
    • Role, BBC News
  • Read am in 8 mins

Fight dey go on for Ukraine since Russia launch full scale invasion more dan three years ago. Ova di past year, Russian forces don slowly expand di amount of territory dem dey control, mostly for di east side of Ukraine and dem don continue dia airstrikes on Kyiv and oda cities.

Ukraine and US officials dey meet to try to refine one US-backed peace plan, dem dey see am like e dey favourable to Russia - Ukraine President Volodymyr Zelensky, tok say di discussion don dey "constructive".

Wit further tok wey go still take place between Russia and US, dis na a look at di situation on ground for Ukraine.

Russia dey grind forward for di east

Inside eastern Ukraine, Moscow war machine don dey move mile by mile through di wide open fields of di Luhansk and Donetsk regions - wey dem dey also call Donbas - surrounding and overwhelming villages and towns.

Dem don dey try to take full control of di area along wit two more regions to di west - Zaporizhzhia and Kherson. Shortly afta di invasion, Russia hold referendum to try to annexe all dis regions - in di same way dem annexe Crimea back in 2014 - but dem never get full control ova dem.

Map of Ukraine dey show areas wey Russian soldiers dey control in red color, areas wey dem dey control in red stripes, and areas wey dem claim say dem dey control in yellow color as of December 1st. Luhansk, Donetsk, Zaporizhzhia, Kherson regions dey show, wit almost all of Luhansk dey in red and plenty parts of di oda three provinces dey under Russian control. Crimea wey Russia take ova since 2014 dey marked as Russian control area too. Big cities like Kyiv, Kharkiv, and Odesa dey marked. Source: ISW

Under di initial peace plan - wey US and Russian officials draft last month – Ukraine go give control of all of Luhansk, Donetsk and Crimea, along wit all di the areas of Zaporizhzhia and Kherson wey Russia currently occupy, to Moscow.

Ukrainian forces go need to withdraw from some parts of Donetsk wey dem still dey hold and dis go become demilitarised area under de facto Russian control. Russian forces go comot from di small areas of Ukraine wey dem dey currently occupy outside dis regions.

Zelensky don consistently say Ukraine no go hand ova di Donbas in exchange for peace, e tok say Russia fit use am as springboard for future attacks.

Following di most recent tok wit US officials, e tok say di "territorial issue na di most difficult" element of di peace deal.

Key towns dey targeted

One report by Institute for di Study of War, (ISW) describe "fortress belt" wey run for 50km (31 miles) through western Donetsk.

"Ukraine don spend di last 11 years putting time, money, and effort into reinforcing di fortress belt and establishing significant defence industry and defensive infrastructure," e write.

Russian try attack near di eastern town of Pokrovsk and dem make rapid advances for north of di town and Russia don recently make advances for di south of di town and east of Kostyantynivka.

Russian officials claim say dem don capture di key strategic town, wey dem dey call Krasnoarmeysk for Russian, e fit give Moscow platform to drive north towards di two biggest remaining Ukrainian-controlled cities for di Donetsk region, Kramatorsk and Slovyansk, but Ukraine deny am.

Map dey show who dey in control for east Ukraine near Donetsk town as of December 1. Areas under Russian soldiers control dey red, plus Donetsk town. Areas wey dem dey shakily control get red stripes, and areas wey Russia claim say dem control dey yellow. E show say Russia no really hold south Pokrovsk tight, but dem claim say dem dey control di north. E still show say Russia no too strong for Chasiv Yar town, wey dey like 40km far east. Source: ISW

"Search and assault operations and di elimination of di enemy for urban areas for Pokrovsk go continue", Ukraine eastern military command tok for one statement wey dem post on social media Tuesday morning.

Open-source intelligence projects wey dey monitor the front lines of di war also suggest say Russian army neva fully capture Pokrovsk.

Di ISW tok say e go take Russia "several years" to take di whole region.

However, also note say Russia casualty rates don fall in recent months despite di more rapid advances and dem say dis one fit be because of di increased use of unmanned aerial vehicles - drones.

Russian incursion north of Kharkiv

Further north, Russia dey claim say dem don take control of di border town of Vovchansk - although Ukraine never acknowledge am and open-source intelligence projects wey dey monitor am again suggest say dem neva fully capture am.

Map dey show where Russian soldiers hold ground for Ukraine near Belgorod on December 1. Red color dey show areas wey dem fully control, red stripes dey show areas wey dem no too hold tight, and yellow dey show areas wey dem claim say dem hold. You go see Belgorod, Vovchansk, Lyptsi, Kharkiv, and Kupyansk for di map. Source na ISW.

ISW analysts say Russia dey try to create security zone inside Ukraine northern border, get within artillery range of Kharkiv, Ukraine second-biggest city.

Russia President Vladimir Putin tok say im want dis buffer zone to protect Russia, afta Ukraine forces collect some land for Kursk north in di summer of 2024. Russia forces eventually drive dem out, wit di help of North Korea troops.

Na map wey dem put side-by-side, you go see how land dey change hand for Russian border between Russia and Ukraine from August 16, 2024, to September 8, 2025. Left side (2024): Purple line show where Ukraine soldiers reach. Right side (2025): Small area cross Ukraine border dey yellow small to show say Russia dey claim say dem dey control am. You go see names like Kursk, Tetkino, and Sumy for di map. Source: ISW

As well as di counter-offensive for di Kursk region, Ukraine don strike air bases deep inside Russia. For one of dis attacks dem use 100 drones to target nuclear-capable long-range bombers.

Di Russia Defence Ministry confam say di attacks hapun for five regions of Russia - Murmansk, Irkutsk, Ivanovo, Ryazan and Amur - but dem tok say na only for Murmansk and Irkutsk planes get damage, while for oda locations, dem stop di attacks.

Kyiv claim say di drone operation don cause $7bn (£5.2bn) of damage to di Russian military. e no dey possible to verify di kontri claim.

More recently, Moscow blame Ukrainian drones for one ogbonge oil depot fire near Russia Black Sea resort for Sochi - di venue of di 2014 Winter Olympic Games.

Ceasefire toks

Since Trump enta office for beginning of 2025, US don dey try stop di war- now na di fourth year, through negotiations.

Trump don dey more sympathetic to Russia pass im predecessor Biden bin dey, and im relationship wey no too tight wit Zelensky reach anoda level on 28th of February, wen im and Vice-President JD Vance blame Ukrainian president for di Oval Office on top live television.

Public relations wit Zelensky don improve in recent months and Ukraine remain critically dependent on deliveries of US-made advanced weaponry, including air defence systems to stop deadly Russian air assaults, as well as intelligence wey dey provided by Washington.

Zelensky warn say Kyiv fit lose US support ova di latest peace plan - di draft, in addition to giving Russia land for require Ukraine to significantly cut down di size of dia army and promise say dem no go join Nato.

Last week, Putin tok say im don see di draft peace plan wey US propose, and say e fit become di 'basis' for future agreement to end di war.

However, Kremlin officials later raise doubt ova weda dem go accept di proposal afta Kyiv and European allies say dem don change some tins for inside.

Three years of fighting

Russia full-scale invasion start wit dozens of missile strike on cities all ova Ukraine bifor early morning on 24 February 2022.

Russian troop move in sharp sharp, and within weeks, dem don dey control of large areas for Ukraine and dem advance to di suburbs of Kyiv.

Russian forces dey bomb Kharkiv, and dem don take territory for di east and south as far as Kherson, and dem surround di port city of Mariupol.

Na dis one be series of four maps wey dey show how Russia take dey control Ukraine from Feb 2022 go reach August 2025.
Feb 2022: Russia no dey control anytin.
Mar 2022: Russia rush enter quickly, areas wey dey red mean say dem dey control am, red stripes mean say dem dey kind of control am.
Nov 2022: Ukraine collect some land back; area wey Russia control reduce.
Oct 2025: Russia dey push forward small small; area wey dem control don increase again.
Di maps show important cities like Kyiv, Kharkiv, Mariupol, Kherson, Kursk, and Pokrovsk. Dem draw line for Crimea with black, to show say Russia don carry am since 2014. Source: ISW

But dem hit very strong Ukrainian resistance almost everywhere and dem dey face serious logistical problems wit poorly-motivated Russian troops wey dey suffer shortages of food, water and ammunition.

Ukrainian forces sharply deploy Western supplied arms such as di Nlaw anti-tank system, wey dey highly effective against di Russian advance.

By October 2022, tins don sharply change and as Russia fail to take Kyiv, dem withdraw completely from di north. Di following month, Ukrainian forces recapture di southern city of Kherson.

Since den, di battle don mostly dey in di east of Ukraine wit Russian forces slowly dey gain grounds ova many months - military experts estimate say between 165,000 and 235,000 Russian service personnel don die since di invasion.

Ukraine bin last update di casualty figures for December 2024, wen President Zelensky acknowledge 43,000 Ukrainian deaths among soldiers and officers. Western analysts believe say dis figure dey under-estimate.

By Dominic Bailey, Mike Hills, Paul Sargeant, Chris Clayton, Kady Wardell, Camilla Costa, Mark Bryson, Sana Dionysiou, Gerry Fletcher, Kate Gaynor and Erwan Rivault

About dis maps

To indicate which parts of Ukraine dey under di control of Russia troops, we dey use daily report wey di Institute for the Study of War and American Enterprise Institute Critical Threats Project publish.

Di situation for Ukraine dey move fast and sometimes di map no go show di changes wey don already hapun.