Death toll for South Korea Halloween crush don reach 151

Hallowen crush for South korea

Wia dis foto come from, Getty Images

At least 151 pipo naim don die for one crush as huge Halloween crowds surge into one narrow street in South Korea capital, Seoul, officials say.

At least 82 dey wunjure for di incident for di Itaewon nightlife area wey bin dey hold im first unmasked Halloween celebrations since Covid.

Reports describe one desperate scene of pipo dey caught up for di crush piling on top of each other.

Most of di wey die na teenagers or pipo for dia 20s. Nineteen na foreigners.

Dem never tok wetin cause di disaster.

After holding one emergency meeting, South Korea President, Yoon Suk-yeol, order task force to be set up to help treat di pipo wey dey wunjure. E also launch an investigation into wetin cause di crush.

With di death toll as e stand, dis na di deadliest disaster for South Korea since 2014, when di Sewol ferry sink killing more dan 300 pipo.

''Crowded area bin dey 'feel unsafe'

Wetin we call dis Video, South Korea Halloween crush: Video show panic as crowd surge

Itaewon na one of di most popular neighbourhoods in Seoul for night out.

Locals and foreigners dey flock there every weekend, but Halloween na one of di busiest nights of di year.

An estimated 100,000 pipo bin come to celebrate dia on Saturday to mark di first Halloween since di start of di pandemic wia gathering sizes no dey limited and pipo no need wear masks outside.

E be like say di crush start for one narrow, sloped alleyway wey dey overcrowded with pipo.

Pictures and videos on social media show say di alley dey so densely packed, pipo no fit move.

Social media messages wey dey posted earlier ifor di evening show some pipo remarking say di Itaewon area dey so crowded dat e bin feel unsafe.

Di BBC Hosu Lee, wey visit di scene, tok say e see "lot of medial staff, lot of ambulances, dem dey take di bodies away one by one".

Oga Lee say thousands dey among di crowds, and a number of bodies dey covered in blue sheets, alongside "ton of police".

"A lot of young pipo bin gathered here tonight. A lot of pipo come to di party and club, wearing costumes and lot of pipo wey I don see dey distraught and sad and chaotic scenes dey," tok Oga Lee.

Photos and videos show a number of both emergency responders and civilians attending to wetin appear to be unconscious pipo for di streets.

For one video numerous responders appear to be performing CPR on pipo for one narrow road for di district.

For another, emergency responders dey try pull out pipo from wetin appears to be pile of pipo bodies following a crowd surge.

Another local journalist tok say one emergency broadcast don dey sent to every mobile phone for di Yongsan District urging citizens to return home as soon as possible due to "an emergency accident near Hamilton Hotel for Itaewon".