Why di Tate brothers dey head to US?

    • Author, Ian Aikman
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

Controversial influencer Andrew Tate and im brother Tristan dey travel to di US after leaving Romania, where dem dey face charges of rape, trafficking minors and money laundering, all of which dem deny.

Questions dey about dem dey allow dem to travel and wetin go happen next with dia legal cases.

Who be di Tate brothers Andrew and Tristan?

Andrew Tate, 38, and im brother Tristan, 36, be dual US-UK citizens wey claim to don make millions from dia social media empire.

Dia online output bin dey controversial even before dia legal troubles, with di two of dem wey dey often attract frequent criticism over offensive statements about women.

Police for di UK don link Andrew Tate to di "quite terrifying" radicalisation of boys and young men for one 2024 report into violence against women and girls.

Dem first arrest di brothers for Romania for 2022. Dem dey face separate, unrelated charges of rape and human trafficking for di UK. Both brothers also deny di charges against dem for di UK.

Why di Tate brothers dey travel to US?

Di brothers bin dey under a travel ban for Romania for more dan two years while dem bin dey under investigation.

Speculation say dem go comot Romania bin don dey mount ahead of dia journey, after di two go quiet on social media.

Dem comot from one Bucharest airport around 03:00 local time (05:00 GMT) ontop private jet wey dey head for Florida, sources don tell BBC.

Prosecutors say di travel ban don dey lifted, and di two US passports don dey returned to dem, but investigations into dia alleged crimes never dey dropped.

Di Tates get big US following and be popular figures among some elements of di American right.

Earlier for February, some of Andrew Tate alleged victims say dem dey "extremely concerned" by reports say US officials don ask for im travel restrictions to dey relaxed.

E come after US special envoy Richard Grenell raise di issue of di Tate brothers with Romania Foreign Minister Emil Hurezeanu for di Munich Security Conference.

Hurezeanu say e bin no consider Grenell approach as a "form of pressure". Grenell tell Financial Times im support for di brothers bin dey clear.

Di Tates be loud supporters of US President Donald Trump, while im close adviser, Elon Musk, restore Andrew Tate' account on X after e buy di social media platform for 2022.

Wetin di Tates and di Trump administration tok about di journey?

Andrew and Tristan Tate never comment yet on dia trip to di US, nor di Trump administration.

Shey dem go need to return to Romania to face trial?

Prosecutors now dey rewrite di cases against di Tate brothers for Romania, as dem allow dem to leave di kontri on di condition say dem go return - possibly as early as di end of March.

Di two dia request to leave di kontri bin dey accepted, prosecutors tok, but dia request for di charges against dem to be dropped bin dey rejected.

Di brothers dey face a number of civic and criminal legal cases.

Di two of dem dey charged with human trafficking and rape along with two Romanian female suspects for June 2023. Dem deny di charges.

Dem dey face separate, unrelated charges of rape and human trafficking for di UK. Last year, one Romanian court rule say dem fit dey extradited to di UK after dia case for Romania conclude.

Separately, lawyers for four women wey claim say dem dey assaulted by di Tates say dem dey bring a civil case against am for di High Court for di UK for "damages for injuries dem suffer as a result".

One representative for di Tate brothers tok in response say dem "unequivocally deny all allegations".

One separate civil case for di UK, wey di brothers dey contest, accuse di brothers and a third individual of being serial tax evaders.

Wetin di Tate alleged victims tok?

Four women wey allege say dem dey sexually abused by Andrew Tate don say dem dey in "disbelief and feel re-traumatised" by news of am leaving Romania.

In a joint statement, di four say: "E dey clear say e no go now not face criminal prosecution for im alleged crimes for Romania; e go use am as an opportunity to harass further and intimidate witnesses and im accusers, and e go continue to spread im violent, misogynistic doctrine around di world."

Dem also ask British authorities to "finally take action, do something about dis terrifying unfolding situation and ensure say e face justice for di UK".

Matthew Jury, one lawyer representing di four alleged victims, tell BBC di Trump administration dey "interfere in due process" in Romania and di UK.

E add say e no think say di Tate brothers go "ever face justice for Romania now".