You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Gossip Girl and Buffy the Vampire Slayer actress Michelle Trachtenberg die at di age of 39
- Author, Yasmin Rufo
- Role, Entertainment reporter
- Read am in 3 mins
Michelle Trachtenberg, wey bin rise to fame as a child star for di 1990s and 2000s, don die at di age of 39. Na wetin di New York Police Department tell CBS News, wey be BBC partner for di US.
Dem bin sabi di American actress well-well for playing Buffy di Vampire Slayer younger sister Dawn Summers.
She later take on di role of manipulative socialite Georgina Sparks for Gossip Girl - wey bin run from 2007 to 2012 - as an adult. Police say dem no dey treat her death as suspicious.
Trachtenberg first act feem for Harriet di Spy for 1996, and she bin appear for plenti Nickelodeon productions.
BBC News don reach out to Trachtenberg representatives for comment.
Police for Manhattan say dem bin respond to one emergency call on Wednesday morning, and dem see Trachtenberg "unconscious and unresponsive". Na for di scene dem confam say" she don die".
"We no dey suspect criminality. Di Medical Examiner go determine di cause of death. Di investigation still dey go on" di NYPD tok for statement.
Trachtenberg start to dey act wen she bin dey three-years-old for di Nickelodeon television series The Adventures of Pete & Pete.
For di early 2000s, dem bin nominate her for several acting awards - wey include Daytime Emmy Award - for her role for Buffy the Vampire Slayer.
She also act for feems like EuroTrip, Ice Princess, Killing Kennedy and Sister Cities.
Trachtenberg bin first appear for Gossip Girl for 2008. She bin return to di role for two episodes of di second season of HBO Max reboot for 2023.
Her last major acting role na for 2021 as di host of a true-crime docuseries Meet, Marry, Murder, wey bin appear on digital streamer Tubi.
For 2021, Trachtenberg bin accuse Buffy the Vampire Slayer creator, Joss Whedon, of inappropriate behaviour on set afta her co-star Charisma Carpenter say she bin dey traumatised due to di treatment she receive from Whedon.