Who be Kim Sae-ron, di South Korean actress wey die at 24

    • Author, Maia Davies
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

Police don confam di death of South Korean actress Kim Sae-ron for Seoul.

One of her friend see di 24-year-old for her house for di city of Seongsu-dong district around 16:55 (07:55 GMT) on Sunday, 17 February.

Officers tok say dem no see any sign of magomago and dem dey investigate di cause of death.

Ms Kim na one of South Korea most hailed young actors, She neva appear for any feem since she face public criticism afta she dey guilty of driving under di influence of alcohol for 2022.

Her death na di latest tragedy to strike for South Korea booming but high-pressure entertainment industry.

Ova di past few years, several south Korea young stars don commit suicide, afta pipo troll dem sake of sometin dem tok or for dia opinion.

Kim Sae-ron life and her top movies as actor

Kim start her career as a child actor and pipo see her as one of South Korea most promising young actresses.

Dem born her for Seoul for 2000, she become popular wit her role for one 2009 film A Brand New Life - wey see her appear for di Cannes Film Festival.

Ms. Kim start her acting career wen she act in "A Brand New Life," one film about one girl dem abandon for orphanage, in 2009. She be 9 years old wen di movie premiere and dem bin invite her to di Cannes Film Festival.

She later feature for South Korea highest grossing film of 2010, The Man from Nowhere and 2012 thriller The Neighbour, and she receive award of recognition for dat feem.

She continue to appear for both big- and small-screen productions, and she gada at least two dozen credits and she receive plenty South Korean acting awards.

Oda notable roles include di 2014 film A Girl at My Door and television roles like Mirror of di Witch for 2016.

For May 2022, Ms. Kim career bin suffer setback sake of one drink-driving accident. Dem catch her say she dey drive under di influence of alcohol.

Di car wey she dey drive bin crash into one guardrail and transformer, wey cut off electricity to dozens of nearby businesses for several hours, according to Yonhap News Agency, wey report say her alcohol level pass 0.2 percent.

Alcohol level wey pass 0.03 percent while driving dey considered as D.U.I. offense for South Korea.

Dem fine Ms. Kim 20 million won (£11,000) for April 2023.and she face serious backlash on social media from di public and influencers, wey condemn her behaviour as irresponsible.

Di actress bin issue apology on her Instagram account, she say "Excuse no dey for dis distasteful incident."

At di time of di crash, Ms. Kim bin dey feem one Netflix series called "Bloodhounds" wey dem release for 2023.

But dem cut out most of her scenes from di final cut, according to di entertainment-industry publication Variety, sake of di driving accident. She no attend di promotional events wit di oda members of di cast.

Afta dat, she withdraw comot from public eye. Local media bin report say di actress bin dey try return to di entertainment industry in small-budget projects and one stage play.

Her last movie na still di Netflix 2023 Korean drama "Bloodhounds," according to reports.

Fans of Ms. Kim don enta social media to express dia grief and pay tribute.