You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
In pictures: How pipo dey pray for Pope Francis around di world
Pope Francis still dey critical condition, na wetin Vatican tok as dem give update on im health, dem say im get respiratory and kidney problems.
Around di world, prayers and services bin take place in support of di pontiff.
For Vatican, pipo gada for St. Peter's Square.
For Rome, dem leave flowers and tributes outside di Gemelli Polyclinic, wia dem dey treat di Pope.
Di Archbishop of di City of Buenos Aires, Jorge Garcia Cuerva, lead mass for Pope health.
Na dis city dem born Pope Francis and im be Archbishop dia for1998.
Pipo pray for Guatemala City.
One woman cry during one mass in honor of Venezuelan Jose Gregorio Hernandez, wey many know as di "Doctor of di Poor," afta Pope Francis approve im canonisation, for Caracas, Venezuela.
And for Mumbai, India, one artist make im own colourful dedication.