Pesin wey dem convict fit run for America president? How dis case go affect Trump

Wia dis foto come from, Reuters
Afta two days of deliberation, New York jury find Donald Trump guilty of all 34 charges in di hush-money case.
Na history making verdict following a history-making trial. Trump na di first US president wit criminal conviction, and first major party candidate wey dey run for di White House as a felon.
Di US Constitution don set some eligibility requirements for presidential candidates: di candidate must be age 35, be “natural born” US citizen and e don live in US for14 years. Rules no dey to block candidates wit criminal records.
But dis guilty verdict fit affect November presidential election. One poll from Bloomberg and Morning Consult earlier dis year reveal say 53% of voters in key swing states go refuse to vote for di Republican e dey convicted.
Another poll, from Quinnipiac University dis month, show say 6% of Trump voters go dey less likely to vote for am - consequential in such tight race.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin go happun to Trump now?
Trump dey on bail throughout di trial and dis neva change afta dem read di verdict on Thursday.
E go return to court on 11 July - di date Justice Juan Merchan don schedule for a sentencing hearing.
Di judge get several factors to consider in sentencing, Trump age.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di sentence fit involve fine, probation or supervision, or possibly prison time.
Trump wey call di ruling "disgrace", go certainly appeal di guilty verdict, di process fit take months or even longer.
Im legal team go face di Appellate Division fo Manhattan, and possibly di Court of Appeals.
Dis all means say even afta sentencing, e dey highly unlikely say Trump go leave di court in handcuffs, as e go remain free on bail while e dey appeal.

Wia dis foto come from, Getty Images
Trump fit go prison?
E dey possible, though highly unlikely, say Trump go serve time behind bars.
Di 34 charges e face na class E felonies for New York, di lowest tier for di state. Each charge carry maximum sentence of four years.
As e dey above, e get some several reasons why Justice Merchan fit choose lesser punishment, including Trump age, e no get previous conviction record, and di fact say di charges involve non-violent crime.
E fit consider Trump violations of di court gag orders during di trial.
E also dey possible say di judge go weigh di unusual nature of di case, perhaps choosing to avoid putting a former president and current candidate behind bars.
Trump, like all former presidents, dey entitled to lifelong protection from di Secret Service. Dis mean say some agents go need to protect am for prison.
Even so, e go dey very difficult to run prison system wit former president as inmate. E get big security risk and e dey expensive to keep am safe.
“Prison systems care about two tins: security of di institution and keeping cost down,” Justin Paperny, director of di prison consulting firm White Collar Advice tok.
Wit Trump, “e go be show… no warden go allow am”, e tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Trump say di trial dey ‘rigged, disgraceful’
For im first comments on di verdict, Trump tok say im no do anytin wrong.
Im accuse Merchan say im dey “corrupt”.
“I be veri innocent man, and e dey OK – I dey fight for our kontri. I dey fight for our constitution,” e tok as e comot for di court room for New York.
“Na Biden administration do dis in order to wound or hurt an opponent, a political opponent. And I tink na just disgrace. And we go keep fighting. We go fight till di end and we go win.”

Wia dis foto come from, Getty Images
Biden campaign respond: 'No one dey above di law'
Di Biden campaign respond to Trump guilty verdict on Thursday, 29 May, as dem write inside one statement: "For New York today, we see say no one dey above di law".
“Donald Trump don always mistakenly believe e no go eva face consequences for breaking di law for im own personal gain," Biden-Harris campaign Communications Director Michael Tyler write.
E den go on to encourage pipo to vote: "Today verdict no change di fact say di American pipo face a simple reality. E still get only one way to keep Donald Trump out of di Oval Office: for di ballot box. Convicted felon or not, Trump go be di Republican nominee for president."
Summary of wetin happun for di trial
- Court convict Donald Trump say im falsify business records for di first criminal trial of di former president.
- Speaking afta di verdict, Trump call di verdict a "disgrace" and attack Justice Merchan, wey bin preside ova di case.
- Di 12 jurors bin deliberate for two days before dem reach a unanimous verdict.
- Di court hear from 22 witnesses ova six weeks, including Stormy Daniels, wey her alleged sexual encounter wit Trump dey at di centre of dis case.
- Trump dey accused of hiding a payment wey im former lawyer make to buy di ex-adult film star silence shortly before di 2016 election.
- Im bin plead not guilty and claim without evidence say di prosecution dey politically motivated.













