Nine tins about Lesotho - di kontri wey Trump say 'nobody don ever hear of'

Women in traditional, multi-coloured Basotho outfits dey sing and dance

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, People from Lesotho are called Basotho
    • Author, Basillioh Rukanga
    • Role, BBC News
  • Read am in 6 mins

US President Donald Trump don say "nobody don ever hear of " di African country of Lesotho - comment wey don "shock" im government.

Na small country for di southern Africa wey almost entirely consis otf mountains and dey completely surrounded by South Africa.

Dis na nine tins to know about di country:

'Di Kingdom wey dey Sky'

Di Kingdom of Lesotho dey made up mostly of highlands, wia pesin fit only reach many villages ontop horse, by foot or light aircraft.

E dey known as di "Kingdom in the Sky" and na di only independent state for di world wey dey entirely above 1,000m (3,281ft) in elevation, according to Encyclopaedia Britannica. Im lowest point na 1,400m.

E dey known to get one of di world most scary airstrips to land on - di Matekane Airstrip get short runway and with long drops for both ends.

The Business Insider website describe flying from di airport as "essentially di same as wen dem push bird out of di nest in order to learn to fly".

E dey completely surrounded by South Africa

Lesotho dey completely surrounded by South Africa, but dey separated by di forbidding mountains.

Not much of im land dey available for farming, with im population wey dey suffer food shortages and dey rely on income from jobs for South Africa. Over di years, thousands of workers don dey forced by di lack of job opportunities at home to find work for South Africa.

Di pipo of Lesotho, wey number more dan two million, share some cultural and language similarities with South Africans. Dia language, Sesotho, na also one of South Africa 11 official languages. In fact, more pipo dey speak am for South Africa - 4.6 million - dan for Lesotho.

Wetin we call dis Video, Watch: Trump say "nobody don ever hear of" Lesotho

Lesotho biggest resource na 'white gold'

Resources dey scarce for Lesotho - na a consequence of di harsh environment of di highland plateau and limited agricultural space for di lowlands.

Im biggest resource na water - wey dey known locally as white gold - wey dem dey exported to South Africa. Diamonds na another major export.

Di highest ski resort for sub-Saharan Africa

One snowboarder perform stunt for slope for Lesotho Maluti Mountains

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Snowboarders and skiers from across di world travel to Lesotho AfriSki

Wen you tink of skiing and snowboarding, you fit dey imagine di snowy slopes of Europe and North America.

But Lesotho dey make imsef known on di snowsports scene. E get di highest ski resort for sub-Saharan Africa, one of just di small wey dey on di continent.

Afriski dey for 3,222m above sea level, high up for Lesotho Maloti mountains and dey attract visitors from Africa and beyond.

Dem dey call pipo from Lesotho Basotho

Dem dey call pipo from Lesotho Basotho.

Some of di cultural items associated wit di Basotho pipo na dia blankets and di Basotho traditional hats, wey dey known as di mokorotlo. Di hat na national symbol and dey for di middle of di country flag.

Di blankets dey made from thick wool, wit colourful patterns wey dey tell di tori of di Basotho pipo history. Di Basotho dey wear dem as shawls for special events and dey give dem as gifts.

Man wrap di traditional Lesotho blanket for body as e pose for foto

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Di Basotho pipo dey well known for dia traditional blankets

E get one of di highest HIV rates for di world

Lesotho get one of di highest rates of HIV prevalence for di world, with one in five adults wey dey live with HIV, and more infections per 100,000 pipo dan most oda countries, including neighbouring Namibia, Botswana and Eswatini.

US government bin don commit nearly $1bn to help di country deal with HIV since 2006, including for prevention, care and treatment services, according to di US State Department.

Prince Harry get long-standing personal charity interests for Lesotho

Like di United Kingdom, Lesotho na a constitutional monarchy. E mean say although e get royal family, na elected prime minister dey run di country.

Lesotho Prince Seeiso - di younger brother of current King Letsie III - na close friends with UK Prince Harry.

Di two don set up charity for Lesotho - Sentebale, wey mean "forget me not". Di organisation dey work with local communities for di country for di grassroots level, helping young pipo wey dey affected by HIV/Aids.

Prince Harry first go Lesotho as a 19-year-old and don return to the country many times since den.

Dem dey export jeans go US

Jeans for long don dey associated wit di American West but nowadays, many of di ones dem dey wear for US come from halfway across di world, for Lesotho.

Lesotho garment factories don make jeans for ogbonge American brands like Levi and Wrangler in recent years. As a result, Lesotho don become known as di "denim capital of Africa".

And no be just jeans - Lesotho na one of sub-Saharan Africa largest exporters of clothing in general to di US.

Last year, Lesotho export $237m (£184m) worth of clothes and textiles go US through di African Growth and Opportunity Act (Agoa), wey allow qualified African countries to send some goods US wigothout paying taxes.

E dey ranked second by value of goods wey dey exported under di deal.

Many of Lesotho clothing and textile factories dey owned by Chinese and Taiwanese migrants.

Moshoeshoe II wear glasses, traditional blanket and mokorotlo . E dey hold horse.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lesotho former King Moshoeshoe II mokorotlo, wear di traditional Basotho hat

Di country wit di world highest suicide rate

Di mountain kingdom get di world highest suicide rate, with 87.5 pipo per 100,000 of di population wey dey take dia own life every year, according to di UN World Health Organization.

Dis na nearly 10 times di global average of nine and more dan double of di country wit di second highest rate, Guyana, wey get about 40.

No single reason dey for dis shocking statistic - experts point to di abuse of drugs and alcohol, di shortage of jobs and di lack of mental health counselling.