Tinubu tell Benue govnor wetin to do afta herdsmen kill 59 for Yelwata attack

Protesters for Benue state June 15, 2025

Wia dis foto come from, Attah Edeh

Read am in 5 mins

President Bola Tinubu say di recent killings for Benue State must stop because goment no go allow di bloodletting for di North central state kontinu.

E describe di latest attack as "depressing", for statement wey e release on Sunday.

Tinubu direct security chiefs to implement im earlier directive to bring lasting peace and security to Benue State.

E also call on govnor Hyacinth Alia to arrange meeting of di two factions wey dey fight for lasting peace.

"I don direct di security agencies to act decisively and arrest perpetrators of these evil acts on all sides of di fight-fight and prosecute dem."

"Political and community leaders for Benue State must act responsibly and avoid statements wey fit further increase tensions and killings," di president.

Di latest attack for Yelwata lead to di death of many villagers for Benue State, North central Nigeria.

Yelwata, na Benue border town wit Nasarawa state wia suspected armed herdsmen attack di pipo on Friday night.

Like many odas, Benue state govnor Hyacinth Alia condemn di attacks and killing of innocent citizens for Yelewata, say ''nobody get right to take anoda pesin life''

Officials say at least 59 pipo die during di overnight attack for central Nigeria. But local sources say di number high pass this one.

Eyewitnesses say na armed cattle herdsmen carry out di attack and police say dem engage di attackers for gun battle.

Dem burn down many houses for di raid on Yelewata town.

"Di police and tactical teams wey dey di town and reinforcement respond sharpaly to di attack and engage di attackers for serious shoot out and some of di attackers di in di process", Benue police tok-tok pesin, DSP Edet Udeme tok for statement.

E add say "na wit great sadness we report say some pipo lost dia lives and oda wunjure".

On Sunday youths enta street to protest di killings wey no be like say e go stop.

Di protesters gather for di Wurukum area of Makurdi, di state capital wit placards to demand goment protection from di herdsmen.

Clashes between herders and settled farmers dey common for central Nigeria. Part of di reason for di fight-fight na sake of competition ova land.

''In di spirit of peace and unity, we dey call on religious, traditional, and political leaders across di state to sensitize and guide di youths wey dey under dia influence against unlawful gatherings or confrontations wey fit go out of control'', govnor Alia tok.

One boy dey drive cattle for Benue state in 2018.

Wia dis foto come from, AFP vis Getty Images

Wetin we call dis foto, Cattle herding na way of life for many pipo for central Nigeria

Two days ago, 25 pipo bin die wen gunmen attack Makurdi di state capital.

Two weeks ago, gunmen bin kill 25 pipo for two attacks, also for Benue state.

Govnor Alia beg citizens to use of official communication channels to report any suspicious activities and to stay informed through credible sources.

''Benue State dey committed to justice, peace, and security for all''. Govnor Alia add.

Deputy Govnor of di state, Barr. Sam Ode we visit di scene of di incident earlier on Sunday say, di Govnor dey work very hard to make sure say di state experience peace.

Goment don beef up security

Govnor Alia assure citizen say dem don beef up security for vulnerable areas.''More tactical teams don start to arrive Benue from federal goment''.

According to oga Alia ''From Sunday dem go also deploy response squad teams for Benue, strategic community dialogues dey go on to enhance active intelligence sharing.

Dem don strengthen di state joint operations units, and goment say dem dey committed to defending di lives and properties of all residents.

Photos of di relocation of IDPs from Yelwata

Yelwata community

Wia dis foto come from, Attah Edeh

Wetin we call dis foto, Benue State Emergency Management Agency oga, Dr James Iorpuu relocate di IDPs from Yelwata to Makurdi International Market
Yelwata community

Wia dis foto come from, Attah Edeh

Yelwata community

Wia dis foto come from, Attah Edeh

Yelwata community

Wia dis foto come from, Attah Edeh

Yelwata community

Wia dis foto come from, Attah Edeh

Wetin di executive secretary, Benue State Emergency Management Agency, Dr James Iorpuu tok wen e relocate di IDPs from Yelwata to Makurdi International Market:

"Na sorrowful moment I welcome di Yelwata community wey herders attack to International Market, na emergency camp wey Benue SEMA arrange to accommodate di victims of unprovoked attacks.

"I dey deeply grateful for di collaborative effort of di Hon Commissioner of Trade and Investment, DG Peace Commission, GM Benue Links and UNHCR for di successful evacuation of di victims. I also wan thank Benue SEMA staff for dia professionalism for coordinating and working tirelessly to manage di displaced pesins into di camp.

'We dey helpless'

Yelwata community protest

Wia dis foto come from, Attah Edeh

Meanwhile pipo for di community come out to protest di killings for Benue state.

Wit green leaves for hand dem shout say ''we don taya, we dey helpless, we don become weak, we dey broken, we dey powerless becos goment no dey help us''.

Oda group of protesters pray to God to touch di heart of leaders especially from di top to intervene.

Di protesters say di killings dey beyond tribe or political affiliation. Dem say noboby dey spared for dis killing not even children wey go be leaders tomorrow.

Di protest bin peaceful and di pipo say wetin dem want na make di authorities take action