Trump sama Nigeria, Ghana and odas fresh tariffs - full list of kontris

Wia dis foto come from, Getty Images
President of di United States Donald Trump don announce fresh tariffs for more dan 90 kontris as im continue to dey reset how global trade dey happun.
Di list of revised tariffs don show say di tariffs dey in line wit di US president policy to reset trade, sabi pesin Deborah Elms tell di BBC.
Trump bin first announce im tariff plan for April wey bin cause chaos around di world economy.
Im later postpone am so kontris including di UK fit negotiate deals.
Dis tariffs mean say companies wey bin dey bring foreign goods into di US go pay taxes to di govment, wey experts tok say dis companies go fit pass di costs onto dia consumers.
Wetin be di new Trump tariff percentage for kontris
Dis na di summary of tariffs on top goods from more dan 90 kontris as di executive white paper for di White House website tok:
African kontris and di fresh tariffs
15% - Nigeria, Ghana, Angola, Botswana, Cameroon, Chad, Cote D'ivoire, DR Congo, Equatorial Guinea, Lesotho, Madagascar, Malawi, Mauritius, Mozambique, Namibia, Uganda, Zambia and Zimbabwe
25% - Tunisia
30% - Algeria, South Africa, Libya
Inside di executive order, some kontris get exceptions.
China still dey negotiate.
Na so Canada dey face 35% tariff wey already don take effect.
Mexico bin dey face 25% fentanyl tariff, 25% car tariff and 50% tariff on steel, aluminium and copper - all go take effect in 90 days.
Goods from di European Union dey face between 0-15% tariff wey go take effect from 7 August.
Brazil don get 10% tariff inside di executive order but dis dey separate from di 40% dem announce; dis dey mean say Brazil dey face 50% tariff on top most of dia goods.
Oda kontris around di world and dia new tariffs
10% - Falkland Islands, United Kingdom and all oda kontris wey dem no list on top di executive order
15% - Afghanistan, Bolivia, Costa Rica, Ecuador, Fiji, Guyana, Iceland, Israel, Japan, Jordan, Liechtenstein, Nauru, New Zealand, North Macedonia, Norway, Papua New Guinea, South Korea, Trinidad & Tobago, Turkey, Vanuatu, Venezuela
18% - Nicaragua
19% - Cambodia, Indonesia, Malaysia, Pakistan, Philippines
20% - Bangladesh, Sri Lanka, Thailand, Taiwan, Vietnam
25% - Brunei, India, Kazakhstan, Moldova
30% - Bosnia & Herzegovina
35% - Iraq, Serbia
39% - Switzerland
40% - Laos, Myanmar (Burma)
41% - Syria
How we take reach dis point?
For 2 April, Trump bin announce wetin dem call 10% "baseline" tariff on top all imports.
Di president tok say goods from about 69 oda trade partners wey di White House don describe as di "worst offenders" (including di EU and China), go face higher rates as payback for dia unfair trade policies.
Dem later postpone dis tariffs for 90 days to allow time to negotiate individual trade deals, and dem extend di deadline.
Days bifor di 1 August deadline, di US and EU bin agree say European goods go face 15% tariff - including cars.
Under dis deal, wey all 27 EU members gatz approve, di trading bloc go charge companies 0% duty on top certain products.
US-Chinese negotiations don dey continue afta di two bin increase tariffs on top goods to more dan 100% bifor dem reduce am temporarily.
Reactions from Canada and oda kontris
Kontris don begin react to America president Donald Trump announcement of fresh tariffs on more dan 90 kontris across di world.
Canada Prime Minister Mark Carney tok say im govment "dey disappointed" by President Trump decision to raise di tariff on top Canadian goods outside di US-Mexico-Canada trade agreement to 35%.
Inside one statement, Carney tok say govment go "focus on building Canada strong" in response to di new tariff.
"Canadians go be our best customer," Carney tok.
"We fit give oursefs more dan any foreign govment go eva take away from us."
Switzerland govment say dem go "analyse di new situation and decide on di next steps" afta di White House announce a higher 39% tariff on Swiss imports to di US.
"Switzerland don be and remain in contact wit relevant US authorities," di Federal Council tok for post on X.
Dem add say dem dey "continue to seek a negotiated solution wit di US".
South Africa say dia president Cyril Ramaphosa "note wit concern" di 30% tariff from 7 August wey Trump announce.
One statement from di presidency say dem go continue to negotiate wit di US, and say "our negotiators dey ready pending invitation from di US".
Dem add say di govment dey finalise one package to help companies wey dey affected by di tariffs.










