Trump say Coca-Cola go change key ingredient inside drink for US

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Ana Faguy
- Role, BBC News, Washington DC
- Read am in 4 mins
United States President Donald Trump say Coca-Cola don agree to use real cane sugar for drinks wey dem dey sell for US.
Coca-Cola dey use corn syrup for im American products, but Trump Health Secretary Robert F Kennedy Jr don show concern about how dis ingredient dey affect pipo health.
"I don dey speak to Coca-Cola about using REAL Cane Sugar for Coke for United States, and dem don agree to do so," Trump write on social media. "I go like to thank all di pipo wey dey for authority for Coca-Cola."
Without direct confirmation of di change for di recipe, one Coca-Cola tok tok pesin say dem "appreciate President Trump enthusiasm" and say " we go soon share more details on new innovative offerings inside our Coca-Cola product range".
Although di sweetener inside Coke wey dem dey sell for US na corn syrup, for many oda kontris Coca Cola dey make dis product sweet in different ways.
Mexico for example, dem dey use cane sugar.
Coca-Cola sweetener for Nigeria
While for Nigeria, Coca-Cola bin dey use aspartame and acesulfame-K for products like Coca-Cola Zero Sugar. E dey use Sucralose for odas and im drinks bin be 50-50 of sugar inside drinks.
But right now, e no too clear weda na di old sweetener, abi na di new one wey bin collect approval from NAFDAC dem dey use.
According to one report from one investigate of Nigeria Federal Competition & Consumer Protection Commission (FCCPC), for October 2019 di company conclude one process of reducing or eliminating di sugar inside dia drinks.
But FCCPC for dia website say dem continue to produce and market di old togeda wit di new formular "without alerting consumers."
Di consumer protection agency add say, for 2019, di company switch back to di 50-50 sugar old formular for drinks like Limca afta NAFDAC give am approval for di new one.
Trump happy wella wit dis development for US wen im post on Wednesday for Truth Social: "Dis go be very good move by dem – You go see. E just get beta!"
For April, Coca-Cola CEO James Quincey tell investors say "we continue to make progress on sugar reduction for our drinks".
Im say dia company for Atlanta don "do dis by changing recipes as well as by using our global marketing resources and distribution network to boost awareness of and interest in our ever-expanding portfolio".
But any decision to use cane sugar instead fit leave bitter taste for di mouth of American corn farmers.
Corn Refiners Association President and CEO John Bode tok for one statement: "Replacing high fructose corn syrup wit cane sugar go cost thousands of American food manufacturing jobs, depress farm income, and boost imports of foreign sugar, all wit no nutritional benefit."
Di US health secretary and im Make America Healthy Again movement dey campaign make companies remove ingredients like corn syrup, seed oils and artificial dyes from dia products, im say dem dey cause plenty health problems.
Kennedy also dey critical of di amount of sugar wey Americans dey consume and tori be say im dey plan to update guidelines for diet for di whole kontri dis summer.
Trump na regular drinker of Diet Coke – wey dey use artificial sweetener aspartame.
Im even get one special button wey im install for di Oval Office Resolute desk so dem go fit to serve am di drink.










