Trump and Musk fight, wetin we know
- Author, Mike Wendling
- Role, BBC News
- Read am in 5 mins
US President Donald Trump dey reason to sell im Tesla, BBC US partner CBS News dey report, dem quote one senior White House official.
Di red car, wey e buy wen e bin dey try to help Elon Musk promote im company, don dey parked for weeks for di White House, dem report.
Di quarrel between US President Donald Trump and im former adviser Elon Musk explode for public, to di point wia dem dey insult each oda, dis na afta di tech billionaire criticise one of Trump key domestic policies.
Di two billionaires quarrel reach anoda level throughout Thursday, dem criticise each oda for di social media sites wey dem own, wey suggest bitter conclusion to dia unlikely alliance.
Di day start wen Trump say im bin dey "disappointed" wit Musk criticisms of im administration centrepiece tax and spending bill, suggesting say dis fit be di end of dia "great relationship".
Musk den accuse Trump of "ingratitude", im add say: "Without me, Trump for lose di election".
After hours of gbas- gbos, Trump downplay di situation. "Oh it's okay," im tell news site Politico. "E dey go very well, never done better." Im aides bin schedule a phone call wit Musk for Friday, di same news site report am.
Musk also appear to believe say im need to patch tins up. Late on Thursday, in response to post by Bill Ackman, one prominent Trump backer, wey suggest say di pair need to make peace, im write: "You no dey wrong".
However, di White House don later tell BBC say di president no intend to speak to Musk today.
Di breaking point for di relationship between di president and im one-time ally come afta weeks wia Musk dey lobby against Trump "big, beautiful" spending bill, wey US House bin pass last month and dem dey wait for Senate vote.
Shortly afta im leave di Department of Goment Efficiency (Doge) afta 129 days on di job, Musk call di bill "disgusting abomination" and im post for X say: "Shame on those wey vote for am: you know you do wrong."
Im argue say di bill will irresponsibly add to US national debt, and im encourage im followers to phone dia representatives to express opposition to di spending plan.
Speaking to reporters during one news conference wit German Chancellor Friedrich Merz on Thursday, Trump defend di bill and say: "I dey very disappointed becos Elon know di inner workings of dis bill pass almost anybody wey dey siddon hia. All of a sudden im get problem wit am."
Im go on to suggest say Musk bin dey vex about di removal of subsidies and mandates for electric vehicles, which fit affect im Tesla business.
Musk deny say dat na di case and im write say: "Keep di EV/solar incentive cuts for di bill, even though e no touch oil & gas subsidies (very unfair!!), but ditch di MOUNTAIN of DISGUSTING PORK for di bill."
"Pork" na wetin dem dey use for US politics to describe wasteful government spending, particularly on tins wey dey meant to curry favour wit particular groups or local areas.
Di partnership between di two men start wen Musk bin endorse Trump last July afta di assassination attempt in Pennsylvania. Di Tesla boss reportedly pour in $290m (£213m) into getting Trump back into di White House.
Wit all di many posts on X afta Thursday news conference, Musk bin take credit for di Republican victory for last November election, e write say: "Without me, Trump for lose di election, Dems go control di House and di Republicans go be 51-49 for Senate."
"Such ingratitude," im add.
Musk go on to post a poll, im asking im followers: "time don reach to create a new political party for America wey actually represents di 80% wey dey middle?"
Ova di course of di day, Musk go on to repost one tweet wey call for Trump to resign, im argue say im global tariff plan go trigger a US recession, and to suggest without evidence say Trump appear for di unreleased files wey dey related to late sex offender Jeffrey Epstein.
Epstein bin chop arrest for July 2019 on charges of sex trafficking and die by suicide while im bin dey await trial. Dat time Trump na president. Im say im bin know Epstein "like everybody know am for Palm Beach" but im bin "fall out wit am a long time ago".
Di White House condemn Musk allegation, press secretary Karoline Leavitt tok inside one statement say: "Dis na an unfortunate episode from Elon, wey no dey happy wit di One Big Beautiful Bill becos e no include di policies wey im want."
For im Truth Social network, Trump claim say Musk "just go CRAZY" and im go on to post: "The easiest way to save money in our Budget, Billions and Billions of Dollars, na to terminate Elon Gomental Subsidies and Contracts. I bin surprise say Biden no do am!"
Musk companies, including Tesla, SpaceX and Starlink get direct contacts wit di US goment and, like many oda businesses, also benefit from subsidies and tax breaks.
In response, Musk say SpaceX "go begin to decommission dia Dragon spacecraft immediately". Di craft dey used to carry pipo and supplies go di International Space Station.
Telsa stock drop by 14% within hours wen di public know about di quarrel.
According to the most recent analysis from the nonpartisan Congressional Budget Office, di spending bill working its way through Congress go increase US national debt by $2.4tn ova 10 years and leave nearly 11 million pipo without goment-backed health insurance.
Di White House disputes those figures, dem say dem no be dem dey account for revenues brought in by increased tariffs.
Musk bin dey in charge of di radical slashing goment spending for Doge, Musk initiate mass sackings and wholesale elimination of departments such as di US Agency for International Development (USAID).
Doge claim say dem save $180bn, although dat number pipo dey dispute am, and e dey well short of Musk initial aim to cut spending by up to $2tn.












