Katy Perry and Justin Trudeau picture add fuel to tori say dem dey date

Katy Perry and Justin Trudeau

Wia dis foto come from, Getty Images / Bloomberg via Getty Images

    • Author, Ana Faguy
  • Read am in 3 mins

E be like say Singer Katy Perry and former Canadian Prime Minster Justin Trudeau don confam dia relationship status afta foto of wia dem hold hands for one event for Paris go viral.

Celebrity news site TMZ bin publish di photographs and video footage as di two of dem dey waka hand-in-hand bifor dem enta one motor. Di foto bin show as Oga Trudeau dey help di singer into di back seat as photographers dey hail am.

Neither Perry nor Trudeau don publicly comment on dia relationship. But speculation don dey grow for weeks wit plenty fotos of di two of dem togeda.

Earlier dis year, Trudeau bin attend one Perry concert wey fuel rumours of romance wit di pop star.

Dia appearance for Paris bin collide wit Perry 41st birthday ova di weekend and e appear to mark dia first public outing as a couple.

Representatives for Perry and Trudeau Liberal party no immediately respond to BBC request for comment.

During one recent tour for London, Perry no tok anytin about her relationship status.

Afta one fan propose to her from di audience during one performance, di singer joke say: "I wish you don ask me 48 hours ago." Dis na just days afta dem first publish fotos of her and Trudeau online.

Perry bifor bin dey inside one long-term relationship wit actor Orlando Bloom.

Di two of dem bin dey togeda for about 10 years and dem get one daughter, dem separate ova di summer.

Trudeau, wey serve as prime minister of Canada from 2015 to 2025, bin dey married to Sophie Grégoire for 18 years bifor di couple go dia separate ways for di summer of 2023. Dem get three children togeda.