Kwanta between Senator Ned Nwoko and Regina Daniels – wetin we know

Regina Daniels during interview with BBC News Pidgin
Read am in 4 mins

Ned Nwoko don break im silence ova di allegations say e dey abuse im wife, Nollywood actress Regina Daniels.

Di Nigerian lawmaker wey dey represent Delta north senatorial district tok say im no dey abusive instead na im wife dey addicted to hard drugs and alcohol, claim wey Regina neva respond to.

Oga Nwoko for social media post allege say im wife dey battle drugs and alcohol abuse and e wan make she kontinu her rehabilitation program ova fear for her life and safety.

Di 64-year-old senator, tok say im no dey violent towards any of im wife but she move comot from house becos she wan get unrestricted access.

"Regina no always like dis. Her current battle wit drugs and alcohol abuse na di root of our problem," e tok.

"She must continue her rehabilitation program, or I fear for her life and safety.

"Now she don move to place wia she get unrestricted access to drugs. I get oda wives, and none go ever accuse me of violence."

Foto of reactions from Regina brother Sammy West

Wia dis foto come from, sir.sammywest/Instagram

Inside one video wey bin go viral on Saturday night, Regina accuse her husband say im send im "thugs" make dem attack her.

Regina Daniels dey cry inside di video while di pipo wey dey around her dey try to console her, she begin dey shout say she no fit tolerate di violence by her husband again.

"For Ned Nwoko house, I be notin, but for my house, I be queen. Not again, I no fit stand di violence, e too much," she tok.

Inside di short video, wey Regina brother, Sammy West, post on im Instagram story, e accuse di senator say im dey violent towards im sister and afta e physically assault im sister, e run commot from di scene.

On Sunday, Oga Nwoko provide evidence to di allegations, showing video wey contain images of cracked windows, table wey di glass don break and damaged car.

E allege say im wife, Regina dey violent and she don hit three staff and destroy properties inside for no reason.

"Regina na di violent one here, slapping and hitting three staff in di past 48 hours and destroying property, including cars and windows, for no just cause.

"Di truth be say, I don set clear condition for her to accept rehab for Asokoro or outside Nigeria especially Jordan wia she no go get access to drugs."

Who be Regina Daniels

Foto of Regina Daniels during one interview wit BBC Pidgin

25-year-old, Regina Daniels na popular acctress for di Nollywood industry.

Regina start her career as child actress at di age of 7. She feature in her first movie for 2007 in di movie "Marriage in Sorrow".

Since den she don feature in ova 100 Nigerian movies including Miracle Child, Python Girl, Spider-Girl, Hanging Coffin, Jaja the Great, Queen Rebecca, among odas.

Regina Daniels marry Ned Nwoko at di age of 18. Dia marriage don reach six years and dem both get two pikin.

Regina na di youngest wife of Ned, and she dey popular as an actress in di Nigeria feem industry. Dem don nominate her for plenti awards and she don win some too.

Regina get five siblings, wey dey supportive of her career and she be Mass Communication graduate and recently she join di Senators Wives Association as dia social secretary.

Senator Ned Nwoko profile

Foto of Ned Nwoko

Wia dis foto come from, PrinceNedNwoko/Instagram

Sixty-four-year-old, Ned Nwoko na Nigerian politician, lawyer and philanthropist.

Ned Nwoko go University of Keele, Staffordshire, wia e bin get im first and second degree in law.

Afta e finish school for UK, dem call am to English Bar for Lincoln Inn, one of di four Inns of Court for London.

Ned Nwoko start im career as lawyer for United Kingdom, wia e gada experience bifor e come back Naija to do politics and business.

For 1995, dem recognise am as di Best Black Lawyer of African Descent for England, for im success in di England legal field.

After e make am well for im legal career for United Kingdom, Nwoko return back to Nigeria for 1998.

E enta politics for 1999 and serve as House of Representatives member, e represent Aniocha/Oshimili Federal Constituency of Delta State from (1999–2003)

Ned na still active politician and e be sitting senator wey dey represent Delta North Senatorial District.