Wia Raila Odinga dey? - Party clear air on health rumour

Raila Odinga standing wearing white wit hat

Wia dis foto come from, Donwilson Odhiambo/Getty Images

Read am in 3 mins

Kenya opposition party don clear air about di health of dia leader Raila Odinga.

Odinga na former Prime Minister of Kenya and plenti tori about im whereabouts and health status don cause serious tok-tok for di kontri.

Di Orange Democratic Movement (ODM) wey Odinga belong to don come out to say evri tok say dia leader dey sick na lie and say na some pipo dey use di news play politics for Kenya.

Odinga tok-tok pesin, Dennis Onyango, accuse former Kenya deputy president say e dey among dose wey dey spread di news about di health of dia leader.

"Di misinformation dey broadcast by di same team wey bin go on a frenzy against Hon. Raila bid for di chairmanship of di African Union Commission earlier dis year."

For Kenya, different news bin dey fly around say Odinga no well.

ODM say Odinga no dey hide im health status even wen e bin dey hospitalised.

"E tell di kontri say e dey undergo procedure wen dem bin hospitalised am as sitting Prime Minister for June 2010."

"E tell di kontri say dem diagnose am wit Covid and dey hospitalised as opposition leader for 2021. E go do di same today if e dey di health situation wey im opponents wish make e dey," ODM statement tok.

Wia Raila Odinga dey?

Di party clear di air on di whereabouts of Odinga and say e no dey Europe like some pipo tok.

Odinga tok-tok pesin confam say im oga no dey di kontri currently, but e no dey 'indisposed' or sick.

"Hon. Raila bin travel out of di kontri, one of di many trips wey e don make.

"E definitely no travel to Europe as some bloggers and media houses bin broadcast am.

"E no dey indisposed, as dem dey pray for am by im frustrated opponents," Onyango tok for im statement.

Who be Raila Odinga

Although Raila Odinga come from one popular family for Kenya, yet di political crown no reach im side throughout im long political career.

Na just di same way e no reach im papa, wey serve as vice-president afta Kenya gain independence from UK.

Wen e be 77 years old, Odinga make im fifth attempt for di presidency for di 9 August 2022 elections.

Di closest e get near power na for 2008 wen dem appoint am as prime minister.

Mr Odinga get passionate followers and im fans nickname am as "Baba" (Father), "Agwambo" (Act of God) and "Tinga" (Tractor) - wey dem pick from im party symbol for 1997 elections.