Di women wey Ooni of Ife marry as Queen back to back

Wia dis foto come from, others
By Jelilat Olawale
Senior Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
To marry plenti wives na one tin wey dey common for African culture and who go fit do dis kain with style if no be ogbonge African traditional ruler.
Dis go explain di latest action Ooni of Ife, one ancient town for Osun State, Southwest Nigeria - belief dey say na di town be di place wia di Yoruba tribe for Nigeria originally comot.
Di present traditional ruler of di town wey dey highly respected by plenti Yoruba pipo na Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi.
Like many Kings before am, Oba Ogunwusi now don get multiple wives for im palace.
For instance, di immediate past Alaafin of Oyo, for Oyo state, late Oba Lamidi Olayiwola dey popular got im plenti wives and many be young women in dia late twenties of early thirties.
Oba Ogunwusi now don marry six wives within two months.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di monarch don marry three times before but di marriages bin fail.
E bin don born one daughter before e even marry atall.
Who be di new Queen for di palace of Ooni

Wia dis foto come from, Ooni of Ife palace
For early September, di palace of di Ooni release one statement say di traditional ruler don marry Mariam Anako as im new Queen.
Di news of di marriage come barely one year after im marriage to popular evangelist and mother of di crown prince, Olori Silekunola, crash.
According to di statement, Olori Mariam na from di Ebira tribe of Kogi state, North Central Nigeria.
Since dia wedding, Oba Ogunwusi and Olori Mariam don appear for few public event. Di recent one na when di king receive national honor from President Muhammadu Buhari for Abuja, Nigeria capital.

Wia dis foto come from, Other
E no too tey wen di news of im marriage to anoda woman enta news space.
Di palace of di Yoruba monarch confam say Her name na Elizabeth Opeoluwa Akinmuda.
Reports say dia marriage happun for Lagos less dan 48 hrs afta Olori Mariam enta palace.

Wia dis foto come from, Queen Tobi / Instagram
E never reach one month wen di news of Oba Ogunwusi new wedding again enta social media.
Videos and photos from di event show how traditional chief gather on behalf of di traditional ruler to Wed Tobiloba Philips wey be graduate of Marine science from di University of Lagos.
Queen Tobi wey be beauty Queen naim belief dey say be di second wife wey Oba Ogunwusi marry as di palace keep mute ontop di mata.
She na from Erinje-Ikale for Okitipupa part of Ondo State.

Wia dis foto come from, Queen Ashley/Instagram
Di latest wife wey Ooni of Ife just marry according to di video wey BBC Pidgin watch na Princess Ashley Adgoke.
Inside di video, di new Queen dey dance as traditional Chiefs of di town spray her money.
Also, di three sisters of di King also dey in attendance in dia full owambe attire.
Dem write for one wedding poster wey we see "traditional wedding between Arole Oduduwa, Olofin Adimula, Ooni Adeyeye Entitan Babatunde Ogunwusi & Ashley Afolashade Afolakemi Adegoke"
Di wedding according to one source inside di palace happun for Ile-Ife as Queen Ashley na from di town.

Wia dis foto come from, Olori Ronke
Another queen wey enta di palace na Princess Aderonke Ademiluyi.
Di Ife princess join di newly wedded oloris of Oba Ogunwusi on 20 October.
According to di palace toktok pesin, Moses Olafare, Olori Aderonke Ogunwusi na great granddaughter of Ooni Ajagun Ademiluyi wey reigned from 1910 to 1930. E succeed Ooni Sijuwade Olubuse 1 and dey succeeded by Ooni AdesojiAderemi wey Okunade Sijuwade II succeed before Ooni Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II come di throne for 2015.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Moses Olafare/Facebook
On Monday, 24 October, 2022 barely one week after Princess Ronke Ademiluyi enta di palace of Oba Ogunwusi as di 5th queen, anoda Princess don join di royal family.
Princess Temitope Adesegun na from Ago-Iwoye for Ogun State, southwest Nigeria.
According to di palace toktok pesin, Moses Olafare, di latest queen na graduate of Business Administration from di University of Lagos.
She also be certified alumnus of several universities, wey include di University of Oxford, INSEAD Business School, Fontainebleau, France; University of Cambridge, Judge Business School, United Kingdom; and Harvard Kennedy School of Government for di United States.
Ooni of Ife, Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi Ojaja II profile

Wia dis foto come from, Ooni of Ife palace
Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi, Ojaja II, 48, ascend di throne of Ile-Ife for 2015 afta dem select am from Giesi Ruling House.
Im predecessor na Oba Okunade Sijuwade wey die on July 28, 2015.
One of di things wey di monarch dey known for na philanthropy.
Everybodi know say im dey committed to di people wey no get.
Yoruba na Nigeria second biggest ethnic group. And di Ooni na one of di most respected King of Yorubaland.
Yorubaland no dey only for south-west Nigeria, e spread reach Togo and Benin.












