Ejections, shouting and hockey players: Key moments from Trump big speech

Wetin we call dis Video, Watch: Partisan divisions and Olympic gold medalists among key moments for Trump address
    • Author, Ana Faguy
    • Role, Washington
  • Read am in 6 mins

For inside wetin don bicom di longest-ever address of im kind, President Donald Trump provide update on America as part of im State of di Union address as e offer victorious - and sometimes combative - remarks, e hail di work of fellow Republicans and outline im future agenda.

Di President dey make dis im annual address to members of di US Congress, im cabinet, members of di Supreme Court – along wit di president family plus oda guests.

Di time of di speech dey crucial for di president, as e come wen tension dey grow for Iran, wen di nation highest court throw way im global tariffs and continued worries ova affordability for US - one issue wey fit help am lose full control of di US Congress for midterm elections later dis year.

Hia na several key moments from im evening for di spotlight, e bin speak to one sharply divided Congress plus an audience of tens of millions of Americans.

1. All eyes on di (half-missing) Supreme Court

Supreme Court justices look on as Trump tok for di House chamber

Wia dis foto come from, Reuters

Dis na di first time - at least publicly – wey Trump go come into contact wit members of di Supreme Court since e yab dem, on top dia decision to throw out im global tariffs.

Di full court bin dey in attendance for di president state of di union address but on Tuesday, only four of di nine justices bin dey present: Chief Justice John Roberts and justice Amy Coney Barrett, Elena Kagan and Brett Kavanaugh.

Wen Trump enta di room, e shake hands wit various lawmakers and wen e reach di justices for di front row, as normal protocol deman, e shake di hand of Roberts as e move go di podium, but di two of dem share one serious look - one possible sign of di lingering tension since di president lambast di six justices, plus Roberts, wey rule against di levies.

Later, wen Trump tok about di ruling and im tariffs policy for im remarks, e again lambast di justices, although dis one no dey as harsh, like di one e do bifor.

Di camera for di room bin point for di direction of justice Amy Coney Barrett - wey Trump bin nominate during im first term, wey also rule against im tariffs.

She no show any emotion as Trump call di ruling "disappointing" and "unfortunate", e look di direction of di justices wey siddon near am close to di front row of di chamber as e tok am.

Trump add say im go turn to oda laws to push im tariff policy ahead – plus di new 15% tariff wey e announce say go replace di ones wey di high court reverse.

Trump compulsory di new tariff by one proclamation e sign under one law wey dem no dey ever use, wey dey known as Section 122. Di law give di presido power to put in place tariffs up to 15% for 150 days, at which point Congress must step in.

On Tuesday, Trump say "congressional action no go dey necessary". E later tok say di tariffs go replace di income tax.

2. Democrat ejected from di room - again

Al Grenne hold one sign wey say "Black People Aren't Apes!" as Trump waka past for di chamber

Wia dis foto come from, EPA/Shutterstock

E don bicom almost normal routine for opposing party to lead protest for di president annual address.

Dozens of Democrats, wey include some for leadership, no attend Trump speech and instead carry out handful of rallies for Washington in opposition to di president and im agenda.

Inside di chamber, di lack of Democrats on one side of di aisle bin dey very clear, as plenty rows of seats dey empty from many camera angles.

Some of di remaining Democrats wey come also lodge dia own protests.

Dem escort Congressman Al Greene of Texas comot di chamber - for a second year in a row.

As Trump enta di chamber, Green hold up one white sign wit black lettering wey read, "black pipo no be apes!"

Members of congress shout and point dia finger at Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Reps Ilhan Omar and Rashida Tlaib repeatedly shout for Trump during im remarks

E be like say di sign dey refer to one video wey Trump post and later delete on social media, wey show former President Barack Obama and former First Lady Michelle Obama as apes.

Di sign and di way e take dey shout make several officials escort am comot di chamber.

During Trump address last year, dem also escort Greene comot sake of im shouting.

Congresswoman Ilhan Omar, one Democrat from Minnesota, no gree too as e also dey shout at di President wen e dey tok about di immigration and alleged fraud for Minnesota Somali-American communities.

"Dat na lie, you be liar," Omar shout as Trump continue dey tok.

She binn seat next to Congresswoman Rashida Tlaib, one Democrat from Michigan, and two of dem bin shout throughout di president remarks.

3. 'U-S-A, U-S-A' - Patriotism on display

Hockey players hold dia gold medals while wearing navy sweaters wit American flags on dem

Wia dis foto come from, Reuters

For inside wetin be like di entrance of a movie, di US men's hockey team bin enta di House chamber, from one area wia members of di press dey seat down, above Trump.

Pipo wey dey di chamber begin clap and chant of U-S-A.

Trump hail di team victory, and announce say Connor Hellebuyck, goalie of di team, go receive di Presidential Medal of Freedom, di highest civilian honour.

On Sunday, dem record di team as dem joyfully celebrate for dia locker room wit FBI Director Kash Patel. While there, Patel bin call Trump and put am on speaker phone to congratulate di team.

Among di president remarks na invitation for di team to come to Washington and di State of di Union. Trump also make one comment wey now don bicom controversial: "I must tell you, we go gatz bring di women's team, you know dat."

The president tok say if im no also invite di women's team, "I do believe dem go impeach me".

Di comments bin go viral online and lead to criticism, wey Trump fit don notice as e use one moment for im speech to announce say di American woman's hockey team – wey also win gold – go come di White House soon.

Patriotism na central theme of Trump speech, as e touch on di planned celebration for di kontri 250th anniversary. But e also use dos issues as a way to showcase divisions for di kontri.

At one point, e ask di pipo wey dey di audience – wey largely be members of Congress - to stand if dem agree wit dis sentence: "Di first duty of di American govment na to protect American citizens, not illegal aliens".

Cameras pan around di room and e show Republicans on dia feet dey hail am, while di oda half of di room siddon motionless.

Trump note several times say Democrats no dey cheer or stand as e list im administration actions and policy wins.

"These pipo dey craze. I dey tell. Dem dey craze," e tok about Democrats at one point.