Why protest dey happun across cities for UK

Wetin we call dis Video, Watch: Burning bin at Holiday Inn Express in Rotherham
Read am in 5 mins

UK Prime Minister Keir Starmer don condemn wetin e call "far-right thuggery" for di form of violent demonstrations across di UK.

Di PM wey follow tori pipo tok for Downing Street on Sunday, 4 August, say those wey dey involved go feel di "full force of di law".

Im comments dey come afta violent protests break out for several cities across di UK on Saturday and further unrest on Sunday.

Di protests wey involve anti-immigration protesters and anti-racism campaigners bin start for towns and cities across Britain, afta three girls die from one knife attack for one children dance class for Southport for northwest England last week.

Police say dem don make 147 arrests across di kontri, and dat number dey expected to rise, BJ Harrington of di National Police Chiefs’ Council tok for one statement.

E blame disinformation for driving di "appalling violence", and add say "often high profile accounts dey share and amplify these posts ".

E also sama warning for those wey get hand for di unrest:

“Intelligence teams, detectives and neighbourhood officers dey work round di clock to identify and apprehend those involved and make no mistake, if dem neva knock your door yet, your time dey come.

Protesters put fire for one bin

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Protesters break windows and set fires for di Holiday Inn Express for Rotherham

Cities wey di unrest don spread go

Di protest wey start for Southport last week, don spread reach London, Hartlepool, Manchester, Aldershot and oda cities.

On Saturday, violence bin break out for cities across di kontri, wey include Hull, Liverpool, Bristol, Manchester, Stoke-on-Trent, Blackpool and Belfast, as di protesters throw missiles, loot shops and attack police for some places.

Around one thousand anti-immigration protestors, some of whom dey shout Islamophobic words bin dey faced by counter-protesters.

On Sunday, di protest further spread go oda cities like Rotherham, Bolton and Middlesbrough.

For Rotherham, hundreds of anti-immigration protesters bin surround di Holiday Inn Express hotel, wia some pipo lit fire, break windows and doors and manage to enta di building wia asylum seekers dey stay.

Masked individuals attack police and force dia way inside di hotel wey dem bin use house asylum seekers.

Trouble bin start outside di Holiday Inn Express, for Rotherham, afta one earlier demonstrations by both anti-racist and anti-immigration supporters.

Police dey struggle wit one man as violence erupt for Holiday Inn Express in Rotherham, following a far-right demonstration

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, Di Prime Minister describe di scenes for Rotherham as "far-right thuggery"

About 100 demonstrators wey dey support refugees and asylum seekers bin stand for outside di Holiday Inn Express Hotel wey dey outskirts of Rotherham for south Yorkshire.

Di crowd dey chant, “say it loud, say it clear, refugees dey welcome here.”

Later anoda group of pipo wey dey against asylum seekers also land di hotel, many of dem dey wave di St George and Union flags and dey chant, “You no dey welcome anymore” and some of dem wear masks.

Crowds for Middlesbrough set fire to one overturned car and push burning wheelie bins for police

Di protest for Bolton wey bin start off peacefully, but later become heated wen two groups clash.

One, wey most of dem cover dia faces wit masks or balaclavas - bin charge towards di town hall begin shout "Allahu Akbar" - or God is greatest. Dem clash wit one separate group wey dey wave di England flags

Far-right demonstrators smash windows for The Holiday Inn Express in Rotherham during demonstration. A man dressed in all black with his face covered is at the front.
Wetin we call dis foto, Dem break plenty windows and police no fit control dem afain

Prime Minister, Home Office react

As e dey follow tori pipo tok from Downing Street, Sir Keir Starmer say those wey dey involved go feel di "full force of the law".

"You go regret say you follow for dis," e tell those wey dey involved for di kasala wey burst for parts of di kontri.

"Justification no dey for taking dia action.

"I no go shy away from calling am wetin e be - far-right thuggery," Starmer tok.

"Justification no dey for taking dis action.

E add say dis "violent mob no represent our kontri" and say: "If you target pipo bicos of di colour of dia skin or faith, dat na far-right and I dey prepared to say so.

"Our police deserve our support as dem dey tackle any and all violent disorder wey flare up."

PM Sir Keir Starmer for one press conference wit two flags of Great Britain behind him and wearing a black suit with a white shirt and red tie.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di Prime Minister say those wey dey involved for di violence go "regret" am

Di Home Office also announce a new "rapid response" security scheme for mosques "at risk of violent disorder".

Home Secretary Yvette Cooper say: "As a nation we no go tolerate criminal behaviour, dangerous extremism and racist attacks wey go against everything our kontri stand for."

Writing on X earlier, Ms Cooper bin say: "Di criminal, violent attack on a hotel housing asylum seekers for Rotherham dey utterly appalling.

"Deliberately setting fire to a building as pipo dey inside. South Yorkshire Police get full Government support for di strongest action against those responsible."

One man for one blue t-shirt throw one item through one hotel window to smash am

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, Dem break several windows across di hotel ground floor

Details about di protest neva still clear. However, Merseyside Police don publicly identify di English Defence League (EDL) as key factor.

While e get pipo wey describe themselves as EDL supporters, di organisation bin cease to exist in any formal sense afta dia founder, Stephen Yaxley-Lennon - wey dey use di alias Tommy Robinson - focus on spreading im message on social media platforms, wia e get sizeable following.

But dia core ideas - in particular na opposition to illegal immigration, mixed wit hate predominantly aimed at Muslims - dey very much alive, and loudly and widely spread among sympathisers online.