'I dey lose millions of naira evriday' - Trader tok how shutdown of Onitsha market dey affect business

Wia dis foto come from, Photo by Patrick Meinhardt / AFP) (Photo by PATRICK MEINHARDT/AFP via Getty Images)
Traders for Onitsha main market dey count dia loses as di market still dey closed.
Na three days now since Govnor of Anambra State, Chukwuma Soludo give order make dem close di market for one week.
E order di closure sake of say traders for di main market no open shop on Monday sake of di 'sit-at-home' wey dem still dey do.
"Going forward, any Monday wey any shop no open go dey locked for one week, all dis shops wey no open and dis market go dey locked up for di whole of dis week, market no go dey anywia for hia." Soludo tok on Monday.
Oga Soludo don keep to im promise as di market dey closed since Monday.
Tori be say security pipo dey for di market and dem no dey allow traders go near di market or even open dia shops.
But na traders di market closure dey affect pass as dem tell BBC Pidgin say dem dey lose millions of naira in one day.
'I dey lose millions in one day' - Onitsha main market trader
One of di traders for di Onitsha main market say, like play, like play tins don dey comot for hand and business don dey spoil.
Oga Chimezie wey dey deal on general goods tok say in just one day e lose over two million naira sake of di closure of di market.
"E get supply wey I suppose do on Tuesday, I no fit do am because security pipo full evriwia, dem no let us open or enta or even go near di market. If we dey get dis kain security on Mondays evribody go dey come market."
Im say no be dem start dis 'sit -at-home' and in di past pipo wey bin don try to open shop, jaguda pipo go dia house attack and kidnap dem.
Oga Chimezie dey para say if to say na only di Onitsha main market wey di govnor and security pipo block e for no pain am, but dem block even shops wey dey for street.
Im ask why oda big markets and oda places no open but na only Onitsha main market Govnor Soludo enta.
Im say if Anambra govment wan stop dis sit-at -home dem know wetin to do.
"Make dem no force us to open shop on Mondays, na our business na about our lives, we dey fear for our lives, we no wan lose our lives" im explain.

Wia dis foto come from, Anambra Police Command
'Onitsha dey calm' - Police
Meanwhile, Anambra State Commissioner of Police, Ikioye Orutugu, dey for front dey enforce public order, safety, and confidence across di city.
For statement wey di Anambra State Police Command tok-tok pesin, Tochukwu Ikenga release, dem say "di Commissioner of Police dey do security assessment tour wey im dey supervise personally and also evaluate di deployment of Police-led Joint Security Forces for strategic locations within Onitsha. "
Di statement say di aim na for proactive engagement wey underscore how di Command dey try to maintain peace, ensure compliance wit lawful directives, and prevent any breach of public order.
Dem say security situation for Onitsha dey calm and under control, as di Command dey kontinu to reassure residents, traders, and commuters of dia safety
Na on Monday dis kasala between govnor Chukwuma Soludo and traders for Onitsha market bin start afta e give order to lock dia shops.
Onitsha, wey be di commercial capital of Anambra State for southeast Nigeria, trend for social media on Tuesday, as traders for di popular Onitsha Main Market para well-well for di state govment sake of di closure of di market for one week.
Di traders bin enta street dey chant songs wey dey support Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra, wey Nigeria court sama life imprisonment.
Dem bin also carry 'we no go gree' waka enta di Onitsha main market wit placards wey dem write different tins.
For one video wey don go viral, di protesters di songs wey dey hail dia alleged leader, Nnamdi Kanu.
Oga Soludo bin dey monitor di Monday sit-at-home exercise wey govnors for di south-east dey try to end since but e neva really work.









