Who be IShowSpeed and why e dey tour Africa?

Wia dis foto come from, TOYIN ADEDOKUN / AFP via Getty Images
- Author, Penny Dale
- Read am in 6 mins
One of di world popular content creators don attract plenty crowd, mostly im young fans, as im undertake 20-nation tour for Africa, e tok say di continent dey "full of surprises".
Pre-teen boys for Rwanda and Ethiopia cry wit joy and excitement as dem hug dia online hero for real life - wey dem sabi as IShowSpeed or just Speed, wey don get ova 48 million YouTube subscribers. Him dey famous for im high-tempo, frenetic and completely unscripted broadcasts wey fit last from three to 11 hours.
African Americans don dey moved as dem see di love and respect wey dem show to dia countryman, wey go soon turn 21 during im "Speed Does Africa" tour.
For Eswatini, dem give am di name "Logijimako" - wey mean "di one wey dey run" - during di initiation ceremony for royal palace to make am become warrior so e go fit protect di king and im family.
Odas ontop social media don name am "Speedani".
Speed, wey im real name na Darren Watkins Jr, get surprised by di reaction of pipo from Angola - di first country wey im visit - wia one fan recreate di beach meme of Speed "my mom's kinda homeless" face.

Wia dis foto come from, Eswatini Tourism
"Bro, I no go lie for you," e tell di chat - di fans wey dey watch and comment for im YouTube livestream.
"I love di love for Africa. Di energy here dey crazy."
Ova 28 days, im and im team dey record, dem plan security and logistics. Dem plan visit 20 countries for Africa, including Nigeria, Ivory Coast, Liberia and Ghana.
E dey plan to see di sights, learn some history, explore daily life, culture and food, play sport, perform high-risk stunts, meet fans and lookalikes, meet some ministers of tourism - and generally experience whoever and whatever come im way as he dey speed-walk and livestream.
"I wan show di world wetin Africa really dey like," Speed declare during im South Africa stop - wia e go car-spinning, learn some amapiano dance moves and get scratched by cheetah.

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images
Some pipo don dismiss di tour as superficial gimmick- di stream go only benefit am alone.
In di AskAnAfrican Reddit forum, Bakyumu from Niger describe di tour as 'quick show' by pesin wey be 'entertainer'.
Speed start as gamer, e blow for 2022, bifor e shift go real life and football content.
Im quick rise dey controversial.
Dem don ban am from all Riot Games' online tournaments becos e dey tok sexist tins against female player. E don apologise and admit say e dey wrong.
E also face ban from YouTube for one week becos e dey allow im game character make demengage in inappropriate sexual activity for viewers make dem see.
Speed don build im brand and online persona on ova-di-top, loud, hyper and sometimes aggressive reactions.
E dey do tins like barking, back flips and athletic stunts - like jumping ova moving cars - and im popular saying include 'What the...' and 'Siuuu', wey e dey shout wen e dey celebrate or dey excited for im football hero Cristiano Ronaldo.
He is just himself - and it's so different to the usual heavily scripted and professionally edited videos"
GenZs and di younger GenAlpha pipo dey love im raw, uncensored content - wia anytin fit happun live on air.
"I dey enjoy di kind energy wey im get and di tins wey hm dey do," Zambian fan Chinyama Yonga tell BBC.
"Even di funny barks wey im dey do," e dey laugh, di 16-year-old wey brave rainstorm to see Speed for action.
In Zambia, Speed jump inside Devil Pool wey dey near di edge of Mosi-oa-Tunya, or Victoria Falls, come rap wit Zambian hip-hop legend Slapdee.
E also go barbers for township for di capital, Lusaka - and plenty pipo gada dia as di news spread for social media.
"E just dey do like imself - and e dey do different from di normal scripted and professional edited videos," Chinyama tok
One young relative of mine dey craze about Speed and e wan tell me why di YouTuber dey ginger youngsters all over di world.
"E dey funny; e sabi do backflips and e dey really kind. E dey donate money and e dey help pipo wey dey face trouble," Henry Dale wey be 11 years old wey dey school for UK tok.
Who be IShowSpeed and wetin we know about im visit to Africa
Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of YouTube post
Darren Jason Watkins Jr wey pipo dey call iShowSpeed, na American internet personality and live streamer.
iShowSpeed wey dem born for Cincinnati, Ohio start to dey create online content since im early teens.
E first focus on gaming videos, livestreaming popular games like NBA 2K and Fortnite but im exaggerated reactions, loud persona and unpredictable behavior make am stand out for di competitive online gaming space.
iShowSpeed get plenti subscribers on YouTube and around 2020 and 2021 im short clips from im livestream blow.
Di viral clips, grow im audience quickly and help am build loyal youthful fanbase wey still dey follow im content closely.
iShowSpeed dey among di most-followed streamers for di world, wit tens of millions subscribers for YouTube and im content dey mixed wit gaming, comedy, music, travel and spontaneous public interactions, usually wit raw, unfiltered energy.
E bin visit Nigeria and oda West-African kontris to meet di local pipo in di kontri and expereince dia daily lives.
During in visit to Lagos, e meet plenty content creators and im presence di city turn into viral moments wey millions of pipo dey watch worldwide.
E meet some local celebrities Peller, Jarvis, Egungun, among oda.
During im meeting wit Egungun wey bin go viral, Egungun ask di streamer im age and compliment im psychique, wey bin go viral
"Speed, how old you be?" and di streamer reply, "I be 21." Egungun tok about im body, "Wow, you dey look healthy and strong." .
E also visit Nike Art Gallery for Lekki, wia dem welcome am and introduce am to di traditional Yoruba culture way.









