Africa: Fifa 2026 World Cup qualifiers Table

    • Author, Rob Stevens
    • Role, BBC Sport Africa
  • Read am in 4 mins

North African side Tunisia join Morocco to qualify for di 2026 Fifa World Cup afta dem top dia group wit 22 points.

Equatorial Guinea lose to di north Africans 0 -1.

Di Fifa International window wey bin open on 3 September don end on Tuesday 9 September across di world even as di qualifiers still dey go on.

Di next window go open for October.

Group A

Egypt dey cruise wit five-point lead ova Burkina Faso.

Group B

Na two points dey separate di Group leaders Senegal and DR Congo wey get 16 points for di three-way fight for top spot.

Group C

Di Bafana Bafana dey comfortable ontop of di Group wit 17 points afta dia 1-1 draw wit arch-rivals Nigeria wey dey struggle for di group.

Group D

Plenti surprises still dey come as Cape Verde begin top Group D wit 19 points afta dem beat Cameroon wey dey behind dem wit 15 points.

Group E

Afta dem become di first African nation to reach di World Cup semi-finals for Qatar 2022, Morocco don set anoda record as dem becom di first team to qualify for di 2026 finals for Africa.

Group F

For Group F Ivory Coast dey lead wit 20 points while Gabon na second for di group wit 19 points afta seven matches.

Group G

Algeria dey four points ahead of Uganda and Mozambique, but Uganda get superior goal difference pass Mozambique wey dey third for di table.

Group H

Tunisia qualify for di World Cup unbeaten and dem neva concede so far, dem get ten-point advantage ova Namibia wey dey second wit 12 points.

Group I

Ghana balance on top of di table wit three-point lead, as dem get 19 points for Group I.

Ghana beat Mali 1-0 for home ground as dem hope to qualify for di 2026 World Cup.

Best losers so far