You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Group standings of 2026 World Cup qualifiers for Africa
African World Cup qualifiers return dis month wit match day five and six.
Di nine group winners at di end of 10-match campaign go qualify for di 2026 World Cup, while a 10th African team go qualify through di intercontinental play-off.
African qualifiers for di finals for United States, Mexico and Canada don resume for March 2025, while di qualifiers for di 2025 Africa Cup of Nations dey scheduled for September, October and November.
See di African group table for Fifa world cup qualifiers.
African World Cup Qualifying table
Group A
Group B
Group C
Group D
Group E
Group F
Group G
Group H
Group I
2nd Place Ranking
How teams fit qualify for di 2026 World Cup?
Caf don cancel di traditional preliminary round wey dem bin dey use bifor.
Di new plan go see all African nations take part for a larger group stage - di 54 entrants dem split dem into nine pools, each group get six teams.
But, Caf plans spoil afta Eritrea late withdrawal from qualifying on 10 November, now Group E get only five teams.
All di kontris wey top dia qualifying group go automatically book dia place for United States, Mexico and Canada tournament.
End of Di one wey oda users dey read well well
While some of di (runners-up) dat one mean second position for table of di nine qualifying groups go get another chance to reach Canada, Mexico and USA.
Di four best-ranked second-placed sides go play for play-offs, wey go see dem play semi-final and final for November 2025 to determine which African side go advance to di intercontinental play-off tournament.
Eritrea withdrawal go affect dis rankings, Caf neva tok yet how dem go take solve dis matter.
Di final global qualifying round go involve six teams wey go compete for di final two places for di 2026 finals, and e dey expected to take place for March 2026.