Death toll from New Orleans attack rise to 15

Wia dis foto come from, Getty Images
Di United States authorities say death toll from di New Orleans attack wey happun on New Year Day don rise to 15.
Dem identify di suspect wey dem accuse of driving di pickup truck wey kill di pipo and injure more dan 35 odas, as 42-year-old Shamsud Din Jabbar.
One statement wey di Federal Bureau of Investigation (FBI) bin release add say di suspect na US citizen from Texas.
Di FBI has also release details about dia investigation. Dem say dem find IS flag, improvised explosive device (IED) and weapons for di suspect pickup truck.
Dem add say dem "also locate potential IEDs for di French Quarter".
According to di FBI, bomb technicians dey work to see if dem dey "viable" and to make dem safe.

Dem also say dem still dey investigate weda di pickup truck wey di suspect bin use belong to am, according to BBC US news partner CBS.
E dey be like say di suspect fit no be di owner of di truck, CBS tok, and e fit be say im steal am or borrow am or rent am.
Sources familiar wit di investigation tell CBS News say di suspect bin wear bodi armour during di time of di attack.
Di FBI say di pesin wey bin drive pickup truck enta crowd don die and dem dey investigate di incident as "act of terrorism".
Inside one statement wey di FBI bin release earlier, dem ay law enforcement officers bin shoot and kill Shamsud-Din Jabbar for di scene of di crime.
"Di FBI na di lead investigative agency, and we dey work wit our partners to investigate dis as act of terrorism," di statement add.
Earlier, Special agent Althea Duncan wey bin take over di case on behalf of di FBI, bin say di attack wey kill 10 pipo and injure 35 odas no be terrorist attack.
Special agent Duncan bin tok dis one for one press conference wey she do wit di New Orleans Mayor, LaToya Cantrell and police superintendent Anne Kirkpatrick.
Duncan tok bin contradict wetin New Orleans mayor bin first tok wen she describe wetin happun as terrorist attack.
Di FBI agent add say dem bin find "improvised explosive devices" for wia di incident happun, and dem still dey work to find out if dem be "viable" devices.
She bin still draw pipo ear say make evribodi no near dat location "until we fit understand wetin dey happun".
Ten pipo die and at least 35 odas injure afta one pick up truck drive enta wia pipo gada for New Orleans, Louisiana, United States, authorities tok.
Di accident happun around 3:15am local time, dat na round 10:15am Nigeria time.
Officials wit Nola Ready, di city emergency preparedness department give update on di number of pipo wey die and injure.
Di New Orleans police superintendent, Anne Kirkpatrick, wey confam di deaths say, dis number fit change.
She say dem never still get enough informate about di pipo wey dey hospital.
E no clear yet how many of di victims be tourists, and how many of dem be New Orleans area pipo, she add.
Di attack occur on New Year Day, for one veri busy tourist destination for New Orleans.
Kirkpatrick say di man bin drive im pickup truck "down Bourbon Street at veri fast speed," and say im bin display behaviour wey show say im do wetin im do wit im full chest.
Di driver bin "try to clear many pipo comot for road," she add.
New Orleans Mayor LaToya Cantrell say dem still dey investigate di exact details of wetin happun and say she dey communicate wit di White House and Louisiana govnor.
She ask "for prayers for pipo wey lose dia life", kon add say make pipo avoid di eight blocks around Bourbon Street, wia di incident occur.
Authorities transport pipo wey wound go hospital, and public safety partners dey di scene.

Wetin eyewitness see
Witnesses tell CBS News, BBC US partner, say afta di driver enta di crowd, e come out of im car begin shoot gun.
One witness wey bin dey Bourbon Street dis morning wen di tin happun share some kain tori wey go make pesin fear.
Whit Davis, from Shreveport, Louisiana, tell BBC: "We bin dey around Bourbon Street since beginning of di evening.
"Wen we dey for bar we bin no hear shooting or crash becos di music bin dey so loud," Davis say. Pipo kon begin run and hide under tables, e add, "like say na active shooter drill".
Police no let Davis and some oda pipo for di bar to move. But wen dem finally allow dem leave, im say "we bin dey waka pass deadi bodi and pipo wey injure all over di street".
One hotel worker nearby tell BBC US partner CBS news say im bin dey close shop for di night wen im hear commotion outside.
"Wen we look out of di window we notice say plenty bodi lie for ground," im tok. "Di truck drive away wit speed."
"I immediately run go downstairs to see if e get pipo wey I for fit help out. "E get some pipo wey we put for inside di hotel for assistance and di whole tin bin just you know... di scene bin just dey horrific."
Di truck go up di street go crash bifor di driver begin shoot officers, police tok.
Social media videos show chaotic scene for di city centre
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Videos wey dey circulate on social media appear like wetin dem record today for di scene of di mass casualties on di ground for New Orleans.
For di video, you fit hear gunfire for di background and you fit see pipo wey dey run from di area.
Witnesses wey speak to CBS News don describe a vehicle wey drive into a crowd on New Orleans Bourbon Street, bifor one driver comot from di vehicle and fire weapon.
New Orleans: Cultural hotspot wey don face hard times
Di city of New Orleans for Louisiana na one place wey dem bin don sabi for long time as place wit correct orishrishi cultural offerings.
Di French establish am for 1718, and di original streets wey dem bin design back den still dey dia, dem sabi am as di French Quarter. Dis na di heart of tourism for di city.
Evri year, more dan one million pipo dey pack demsef go di famous Mardi Gras carnival and parade during raining season, wey dey famous for di strings of colourful beads wey party-goers dey wear.
Historically New Orleans na home to one veri big black community, dem also sabi di area as di place wia dem born jazz music, and dis make am di ogbonge destination for music lovers.
But dis city don face struggles in recent years.
Later dis year dem go mark 20 years anniversary of Hurricane Katrina, wey strike di city of New Orleans and leave about 80% of am under water.
Na almost 2,000 pipo die for Katrina hand and one million bin dey displaced for di disaster.
Di storm destroy most of di city, e bin take years to rebuild.
To add to all dis, in recent years, di population dey steadily reduce.










