You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'My Brothers Keeper' - Anthony Joshua make first post after car crash wey kill im friends
Anthony Joshua don post ontop social media for di first time since di car crash for Nigeria wia e injure and wey kill two of im close friends.
On Sunday morning e post two pictures for im social media account, one show am wit im mama and family members of di victims including di mama of Sina Ghami and Latif 'Latz' Ayodele, with one of dem wey hold Ghami photograph,
E caption di post: "My Brothers Keeper."
Dem born di British boxer, 36, for Watford, but e get family roots for Sagamu for Ogun State south west of di kontri, na dia e bin dey go wen di fatal accident hapun.
Reports say Joshua bin dey on im way to visit relatives for new year celebrations for Sagamu wen di accident hapun.
Im and im close friends and team members Sina Ghami and Latif 'Latz' Ayodele bin dey di Lexus SUV wey jam one stationary truck for di major expressway near Lagos.
Im friends die for di the crash but Joshua sustain minor injuries.
Dem do dia funeral for one London mosque on Sunday.
Dem carry di former two-time heavyweight champion go hospital, dem discharge am on Wednesday before e return to UK dis weekend.
Meanwhile, reports say authorities charge di driver Adeniyi Mobolaji Kayode, 46, for Sagamu Magistrates Court on Friday for charges wey include causing death by dangerous driving.
Dem grant di defendant bail of 5m naira (£2,578) and remand am for prison pending wen e meet im bail conditions. Di case dey adjourned until 20 January.
Di accident hapun not long after Joshua recent victory over American YouTuber-turned-boxer Jake Paul on 19 December.