Trump tok about going for a third term

    • Author, Bernd Debusmann Jr
    • Role, at the White House
  • Read am in 3 mins

US President Donald Trump no rule out di possibility of seeking a third term for di White House, as e say e go "love to do am".

But Trump reject di possibility of running for vice-president for 2028 - one idea wey some supporters dey tok about as a way for am to dodge di US constitution wey stop di president from running for a third term.

Speaking to reporters during im trip to Asia, Trump describe di idea as "too cute" and say e "no go dey right".

E no dey clear which method e go wan use to run again. Last week, former Trump strategist Steve Bannon say "plan" dey in place to secure di 79-year-old president anoda term.

Speaking to reporters inside Air Force One on im way to Japan from Malaysia, Trump say while e go "dey allowed" to run again as vice-president, e no get plans to do so.

"I think pipo no go like dat," e tok. "E dey too cute. E no go dey right."

Talking about di possibility of a third term, Trump say: "I never really tink about am. But I get di best poll numbers wey I don ever get."

Additionally, Trump also suggest vice-president JD Vance and Secretary of State Marco Rubio as potential successors, calling dem "unstoppable".

"All I fit tell you na say we get a great group of pipo, wey dem no get," e add, referring to Democrats.

Trump fit serve a third term?

Di 22nd amendment of di US constitution stop presidents from seeking a third term.

To remove dis amendment go need approval from two-thirds of both di House of Representatives and di Senate, or a constitutional convention wey two-thirds of state legislatures go call - a process wey dey viewed as highly unlikely.

Di amendment go also need to get di backing of 38 states to ratify am, or make am officially valid.

Last week, former Trump adviser Steve Bannon - wey remain a vocal supporter - claim say "plan" dey to secure a third term for Trump.

"Trump go be president in '28, and pipo suppose to just get accommodated wit dat," Bannon tell The Economist. "At di appropriate time, we go lay out wetin di plan be."

For March, Trump tell CNBC say e go "probably not" run again, though e later say e bin "no dey joke" about di possibility.

E still no dey clear which Democrats intend to run for White House for 2028, although several pipo don already express interest.

On Sunday, California Govnor Gavin Newsom tell CBS, BBC US partner, say e go "dey lie" if e say e no dey seriously consider a presidential bid.

Former vice-president Kamala Harris also don tell BBC say she fit run again and sat she "possifit bly" be president for future.