'I never finish' - Kamala Harris tok say she fit run for president again

    • Author, Laura Kuenssberg
    • Role, Presenter, Sunday with Laura Kuenssberg
  • Read am in 6 mins

Former US Vice-President Kamala Harris don tell BBC say she fit run again for White House.

For her first interview for UK, Harris tok say she "fit" be president one day, and she believe say woman go enter White House for future.

She give her strongest hint say she go contest again for 2028 afta she lose to Donald Trump last year. Harris no send di polls wey tok say she no be favourite for Democratic ticket.

As she dey tok for one interview wit Laura Kuenssberg, Harris still blast her former rival, Trump, and say all di warning wey she give about am during campaign don turn out true.

As Democratic Party dey find answer about how Republican Donald Trump take win dat strong victory last year, many pipo don blame former President Joe Biden say e no step down early enough.

But some pipo still dey ask whether Kamala Harris for don run better campaign and tok clearer about di number one issue wey concern pipo, di economy.

For di BBC interview, Harris say she still dey reason anoda chance at di White House, say her grandnieces go, "in dia lifetime, for sure", see a female president.

Wen dem ask am if e go be her, she say, "possibly", confirming say she dey consider anoda attempt at di top job.

Harris say she never yet make decision, but underline say she still see herself as having a future in politics.

"I never finish," di former vice-president tok. "I don live my entire career as a life of service and e dey my bones."

Wen dem ask her about di odds wey put her behind even Hollywood actor Dwayne "Di Rock" Johnson for Democratic ticket, she laugh tok say she no dey follow polls.

"If I dey follow polls," she say, "I for no even run for my first office, or my second and I for no even dey sit down hia today."

Harris still tok say all di predictions wey she make about Donald Trump don come true say e go behave like fascist leader and run govment like dictator.

"She tok say Trump promise say e go use Department of Justice chase pipo wey e no like and na wetin exactly e don do."

She point example of wetin hapun wen ABC suspend late-night comedian Jimmy Kimmel after e crack joke about how Republicans react to di death of right-wing influencer Charlie Kirk.

Trump celebrate di suspension after di regulator wey e appoint threaten Kimmel station.

Harris tok say, "If you look wetin hapun, e don use federal agencies dey chase political satirists... E no fit take small criticism from joke, and e try shut down a whole media organisation bicos of am."

Harris also blast some business leaders and institutions for America wey, according to her, don too quick bow down to President Trump demand.

"She tok say many of dem don dey bend knee for tyrant right from day one, some bicos dem wan stay close to power, some bicos dem wan make merger pass, or make dem no face investigation."

Wen dem ask White House about Harris tok, dem no take am serious.

White House spokesperson Abigail Jackson tok say, "Wen Kamala Harris lose di election wit big margin, she suppose don understand say Americans no send her lies again. Or maybe she don understand, and na why she dey go foreign media dey talk her complaints."

Harris just release her new book titled 107 Days - na di number of days wey she take run for president afta Joe Biden comot from di race because of plenty tok about im health condition.

For di full BBC interview wey go show for Sunday, di presenter ask Harris many times weda she suppose don tell Biden make e step aside earlier.

Dem also ask how much she know about Biden health, and weda she believe say she for don be president now instead of Trump if Biden quit early.

Harris reply say nobodi fit know, dat one na di big "if" wey maybe for change di future of America.

Among Democrats wey still dey reflect on wetin cause dia wahala, many dey blame Kamala Harris campaign. Dem tok say her weakness as leader na part of di reason why she lose, no be just because Biden comot from di race late.

Wen dem ask am wetin really go wrong, she no go deep into analysis. She tok say because she start her campaign late, winning no be sometin wey easy at all.

But as she sidon tok wit BBC for one fine London hotel instead of di gold-plated Oval Office wey Donald Trump don decorate, e clear say Harris still dey tink about power.

Bifor, anytime dem ask her about running again, she dey always dodge am wit "maybe, maybe not" or "I no dey focus on dat now."

But dis time, she tok am more open. She quick put herself for di picture as person wey fit contest again even though she never tok am wit final mouth.

E shock many pipo because di way she take describe her last loss as sometin wey really wound her deep. She and her campaign team no expect say dem go lose, so wen di result show, she tok say she just dey repeat for herself:

"My God, my God, wetin go hapun to our kontri?"

Harris try explain her loss by saying di difference between her and Trump votes no too wide. True true, di popular vote tight well-well na less dan 2% separate dem. But for di main electoral college votes wey dey decide who go win, Trump beat am clear.

Even though she don drop plenty hints say she still dey plan her political future, Harris and oda big Democrats never really face di main problem wey dey worry dia party.

Di question still remain how one centre-left party wey get normal leaders go fit stand against one right-wing populist like Trump?

Dem go focus all dia energy on Trump imself? Or dem go try tok strong for di common pipo wey dey for Main Street?

Wen I ask di former vice-president why her campaign no connect well wit ordinary working pipo, she tok say she need more time to do dat kind tin. She even point out say plenty of dos kain pipo don dey waka comot from her party since.

She tok say she still regret say for 2024, she no get enough time to tok about basic tins wey mata to pipo like house rent, childcare, and daily survival.

But even if she get more time next time around, e no sure say her message go still sweet pipo ear or convince dem better.

Kamala Harris still dey waka wit all di package of big politicians. Her aides dey always watch time like soldiers, bicos evri minute of her day dey planned tight. Na travel here, media appearance dia evritin arranged to perfection.

Dis time around, she no dey campaign for election she dey move round for her book tour. But who know? If she get her way, e fit just be say dis na di beginning of anoda presidential campaign.