Despite all di reactions Israel foreign minister pay historic visit to Somaliland

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
- Author, Abdirahman Ali Dhimbil
- Role, BBC Somali
- Author, Wedaeli Chibelushi
- Read am in 3 mins
Israel foreign minister don arrive for di breakaway state of Somaliland, as e mark di first official visit since Israel bin controversially recognise Somaliland as independent kontri.
Gideon Saar land for di capital city Hargeisa on Tuesday and meet wit Somaliland President Abdirahman Mohamed Abdullahi, according to wetin govment sources for dia tell di BBC.
Last month Israel become di first kontri for di world to recognise Somaliland, wey declare independence from Somalia more dan 30 years ago.
Somaliland president call Israel move "a historic moment", but Somalia reject di development as an attack on dia sovereignty.
Di Israeli foreign ministry neva publicly comment on di foreign minister trip, but one diplomatic source for Somaliland tell di BBC say di intention of di visit na to advance political and strategic partnerships.
Israel decision to recognise Somaliland as an independent nation bin spark condemnation from many oda countries.
Majority of United Nations Security Council members don condemn Israel recognition of Somaliland.
Permanent members of di Council like di United Kingdom and China don reject di move and reaffirm dia support for Somalia sovereignty and territorial integrity.
Di United States na di only Security Council member wey no condemn Israel decision.
Somaliland declare independence from Somalia for 1991, afta di overthrow of Somali military dictator Siad Barre.
Howeva, di region bin remain largely unrecognised for di global stage and Somalia consider Somaliland to be part of dia territory.
Israel recognition of Somaliland last month come as a surprise, wit Israeli President Benjamin Netanyahu citing Somaliland "right to self-determination".
Dis move really spark international condemnation and even call for emergency meeting of di UN Security Council.
China, Turkey and di African Union dey among dose wey criticise Israel step, while di European Union say make dem respect Somalia sovereignty.
Di US defend Israel, say dose wey dey criticising dem get double standards.
For one statement afta Israel announcement, Israel foreign minister Saar say: "Somaliland no be just dis past weekend dem create am. E don exist as functioning state for more dan 34 years.
"Di attacks on Israel recognition of Somaliland dey hypocritical. Only Israel go decide who to recognise and wit who dem fit maintain diplomatic relations."
President Abdullahi say Somaliland go join di Abraham Accords, a deal by di Trump administration for 2020, wey see to how a number of Arab states establish ties wit Israel.
Israel don pledge to cooperate wit Somaliland for agriculture, health, technology and di economy.
Sabi pipo say e get strategic reasons for Israel declaration.
"Israel need allies for di Red Sea region for many strategic reasons, among dem na di possibility of a future campaign against di Houthis," Israeli think tank di Institute for National Security Studies say.









