Who dey run Venezuela now after Trump capture President Nicolas Maduro?

Wia dis foto come from, EPA/Getty Images
Venezuelan President Nicolas Maduro and im wife Cilia Forez don plead not guilty to four charges of drug trafficking and terrorism bifor one federal court for di United States dis Monday afta American soldiers bin gbab dem for one ogbonge operation last week.
Dis don leave big vacuum for di leadership of di South American kontri as many pipo dey ask who dey in charge now.
Maduro capture don start big tok-tok among World Leaders and di United Nations Security Council go hold meeting dis Monday to discuss di mata.
Meanwhile, US President Donald Trump bin don tok say di US go dey run Venezuela until dem fit arrange beta transition timetable to hand power over di kontri.
However, Delcy Rodríguez wey be Maduro deuputy don take oath of office as acting president dis Monday.
Rodríguez na loyal lieutenant for Maduro, and she dey always appear for public events side-by-side with di president and im wife.
Shortly afta US forces capture Maduro and im wife, Rodríguez condemn di action and tok say Maduro remain Venezuela "only president" and say di kontri no go eva be US colony.
But for her first cabinet meeting on Sunday, Rodríguez tone dey different as she tok say dem dey "invite di US govment to collaborate wit us on agenda of co-operation orientated towards shared development witin di framework of international law".
For di swearing-in event on Monday, Rodríguez tell di National Assembly say she dey do am "wit pain" bicos of di suffering wey "illegitimate military aggression" don cause.
She promise say she go guarantee di peace of di kontri, "di spiritual tranquillity of our pipo, di economic and social tranquillity of our pipo".
However, Trump insist say na im dey in charge of Venezuela and on Sunday, di US President bin cut Rodríguez serious warning as e tok say: "If she no do wetin dey right, she go pay very big price, probably bigger dan Maduro."
Also, for anoda interview wit di NBC, President Trump say dem go first fix Venezuela bifor any elections fit happun dia.
And wen di tori pesin ask am who effectively dey in charge of Venezuela, Trump ansa "me".
Who be Delcy Rodríguez?
Delcy Rodríguez - now Venezuela acting president - na lawyer and diplomat, and she bin don hold plenty political offices under Maduro.
Di 56-year old from Caracas bin study law for di Central University of Venezuela.
She don spend more dan two decades as one of di leading figures of chavismo, di political movement wey former President Hugo Chávez bin start, and Maduro don be di leader since Chávez die for 2013.
Her broda, Jorge Rodríguez, na di current president of di National Assembly.
Rodríguez bin work as di minister of communication and information from 2013 to 2014 and foreign minister from 2014 to 2017.
She don defend Maduro administration against international criticism, including accuse say democracy dey go down and human rights abuses dey rise for di kontri. Rather, Rodríguez dey claim say oda govments dey try to undermine Venezuela.
Rodríguez bicom di president of di Constituent National Assembly in 2017, and di assembly come give more power to di govment afta di 2015 legislative elections wey di opposition bin win
Later, in 2018, President Maduro make Rodríguez vice president for im second term, and she continue for dat position for Maduro third term for January last year.
Asides from say she be vice president of Venezuela, Rodríguez na also di chief economic authority and minister of petroleum.
Wetin Trump do for Venezuela dey legal?
Di debate don continue to dey go on about weda di arrest of President Maduro and im wife for inside Venezuela dey legal or not.
According to di US constitution, na di U.S. Congress get di power to declare war but di Justice Department don clarify say wetin hapun for Venezuela no be war.
Also, international law no allow di use of force for international relations except for veri serious exceptions like self-defense or if di U.N. Security Council authorise am.
Some Democratic lawmakers for di US congress don accuse Trump action for Venezuela as "lawlessness".
Senate Minority Leader Chuck Schumer tok for one interview say even though e agree say Maduro na horrible person, "You no suppose treat lawlessness wit anoda lawlessness".
"We don learn through di years say wen America try to do regime change and nation building in dis way, na di American pipo dey pay di price in both blood and in dollars," Schumer tok.
House Minority Leader Hakeem Jeffries also tok say di military operation wey di Trump administration bin carry out witout approval from Congress, "no be simply narcotics operation".
"Na act of war. Dis na a military action involving Delta Force, involving di army, apparently involving thousands of troops, involving at least 150 military aircraft, perhaps involving dozens of ships off di coast of Venezuela and South America," Jeffries tell NBC tori pipo.
However, US Secretary of State Marco Rubio tok say e bin no dey necessary to inform Congress about di operation "bicos dis no be invasion".
E describe am as "law enforcement operation", and e say na FBI agents for di ground na dem arrest Maduro.
You no fit notify Congress of operation like dis bicos "e go leak", Rubio tok.
E also point out say di US no recognise Maduro as di legitimate president of Venezuela.
32 Cubans kpai for US operation for Venezuela
Meanwhile, di govment of Cuban don tok say 32 of dia pipo bin kpai during di US operation to capture Venezuela president Nicolás Maduro.
Cuban President Miguel Diaz-Canel say di pipo wey die na members of dia armed forces and intelligence agencies, who bin dey provide protection to Maduro and im wife "at di request" of Venezuela.
One official govment statement tok say: "Our compatriots fulfill dia duty wit dignity and heroism and dem fall afta strong resistance, in direct combat against di attackers or as result of bombings on di facilities."
Di two govments na long-standing allies, and Cuba dey usually provide security support to Venezuela in exchange for oil.
President Diaz-Canel don declare two days of mourning for di pipo we die.
Following di US operation for Venezuela, questions don dey come up weda di Trump administration fit also consider similar operation against Cuba; di two kontris no too dey friendly wit each oda for long.
On Sunday, President Trump say military action no go dey necessary bicos "Cuba dey ready to fall".
"I no tink say we need any action. E be like say e don dey go down." Trump tok.
Wetin go hapun next for Venezuela?
Even though US officials don indicate say dem no dey plan any further military intervention for Venezuela, Trump tok say "we no dey afraid of boots on di ground", wen tori pipo ask am weda e go send US troops dia.
Trump also say US oil companies go move in to fix infrastructure "and start making money for di kontri".
E say, "we go take tremendous amount of wealth from di ground" wey go go to di pipo for Venezuela and to di US, and e add say "we go get reimbursement for evritin we don spend".
E also tok say di US go sell oil to oda kontris.
Venezuela na wia di largest proven oil reserve for di world dey, but di type of oil na di one wey sabi pipo dey call "heavy, sour" oil.
Dis type of oil dey harder to refine but e dey useful for making diesel and asphalt, while di US dey typically produce "light, sweet" oil wey dem dey use to make petrol.






