Trump say US go 'run' Venezuela and 'fix oil infrastructure' after Maduro capture - how world leaders dey react
- Author, Ana Faguy
- Read am in 5 mins
US President Donald Trump don say US go "run" Venezuela until dem fit ensure a "safe, proper and judicious transition", after US strikes lead to di capture of di kontri President Nicolas Maduro.
US oil companies go also fix Venezuela "broken infrastructure" and "start making money for di kontri", Trump tok.
US launch strikes on Venezuela on Saturday wia US forces capture Maduro and im wife, First Lady Cilia Flores and remove dem from di kontri.
Venezuela announce a state of national emergency and denounce di "military aggression", wit di kontri vice president saying Maduro na dia only leader.
Dem fly Maduro and Flores out of di capital of Caracas on US helicopter in di early hours of Saturday morning and take dem ontop di USS Iwo Jima to an unknown location for di Caribbean Sea.
Dem later fly dem go Guantanamo Bay US Naval Base for Cuba before dem transfer dem to anoda plane to head to New York State, and dem use helicopter fly dem into New York City Metropolitan Detention Center for Brooklyn.
US Attorney General Pam Bondi say dem don indict Maduro and Flores for di Southern District of New York.
D two don dey charged wit conspiracy to commit narco-terrorism and import cocaine, possession of machine guns and destructive devices, and conspiracy to possess machine guns and destructive devices against US.
"Dem go soon face di full wrath of American justice on American soil in American courts," Bondi write on X.
Previously, Maduro demy say e be leader of a cartel and bin don accuse US of using dia "war on drugs" as an excuse to try to remove am sake of Venezuela oil reserves.
Speaking for one news conference before Maduro arrival for New York, Trump say: "Di oil business for Venezuela no get head, e no get head at all for a long period of time."
"Our very large United States oil companies, di biggest anywhere in di world, go go in, spend billions of dollars, fix di badly broken infrastructure, di oil infrastructure, and start making money for di kontri."
Di South American kontri get approximately 303 billion barrels worth of crude, accounting for about 20% of di world oil resources, according to di US Energy Information Administration.
E no clear exactly how US plan to "run" Venezuela, but di president say na a "group" of pipo go lead di charge.
"We go run am wit a group, and we go make sure dem run am properly," Trump tok.
Wen reporters ask who inside Venezuela go form part of dat group, Trump say Secretary of State Marco Rubio dey talk to Delcy Rodríguez, di kontri vice president.
Trump say Rodríguez don express her willingness to do "whatever US ask".
However, speaking on state TV after Trump remarks Rodríguez call Maduro di "only one president in Venezuela", adding say di govment dey ready to defend itself.
Earlier, Rodríguez be di first Venezuelan official to speak out publicly after di US strikes, asking US to provide a proof of life for Maduro and im wife.
In di early hours of Saturday, US launch a "large-scale strike" on Venezuela where US forces capture Maduro and im wife and fly dem out of di kontri, before dem transport dem on board USS Iwo Jima.
How world leaders don respond
Leaders around di world don respond wit a mix of condemnation and support to di US capture of Venezuela President Nicolás Maduro.
For im initial response, UK Prime Minister Keir Starmer say im govment no go "shed tears" for di end of Maduro regime.
Neighbouring Latin American kontris condemn di actions, also Venezuela long-term allies, Russia and China too. China say dme dey "deeply shocked and strongly condemn" di use of force against a sovereign kontri and im president.
Russia accuse US of committing "an act of armed aggression".
Iran, wey also get im own issues wit Trump over im promise of intervention for di kontri, call di strikes "violation of di kontri national sovereignty".
Brazil President Luiz Inacio Lula Da Silva write on X say di actions "cross an unacceptable line", adding say "attacking kontris in violation of international law na di first step toward a world of violence, chaos, and instability".
Colombian President Gustavo Petro call di strikes an "assault on di sovereignty" of Latin America, while Chile President Gabriel Boric express "concern and condemnation" and call for "a peaceful solution to di serious crisis affecting di kontri".
Cuban President Miguel Diaz-Cane accuse US of a "criminal attack", while Uruguay for official statement say dem dey monitor developments "wit attention and serious concern" and "reject, as dem don always do, military intervention".
Venezuelan Interior Minister Diosdado Cabello ask citizens to remain calm and to trust di kontri leadership and military, saying "di world need to speak out about dis attack" according to news agency Reuters.
But Argentinian President Javier Milei – wey Trump don describe as im "favourite president" – write "freedom moves forward" and "long live freedom" on social media.
Meanwhile, UK Prime Minister Sir Keir Starmer refuse to tok on whether or not di military action fit don break international law.
E no condemn di US strikes for one interview wit BBC Sunday with Laura Kuenssberg programme on Saturday morning
E say e dey wait to establish all di facts but say e no go "shy away from dis", adding say e be a "lifelong advocate of international law".
Later on Saturday, e posted on X say UK "regard Maduro as an illegitimate president and say dem no go shed tears about di end of im regime".
EU top diplomat Kaja Kallas stand strong on di bloc position say Maduro lack legitimacy, say make peaceful transition of power hapun, and say di principles of international law must be respected.
French President Emmanuel Macron say di transition of power "must be peaceful, democratic, and respectful of di will of di Venezuelan pipo" for post on X.
German Chancellor Friedrich Merz say di legality of di US operation dey "complex" and international law must be applied generally.
UN Secretary General Antonio Guterres say e dey "deeply concerned say di rules of international law no dey respected", im spokesperson tok. E bin dey "deeply alarmed" by di strikes, wey set a "dangerous precedent".
For di US, Senate Minority Leader Chuck Schumer, wey be Democrat, say: "Let me be clear, Maduro na illegitimate dictator, but launching military action without congressional authorisation, without a federal plan for wetin go come next, dey reckless."
Prime Minister Benjamin Netanyahu of Israel, wey be strong US ally, congratulate Trump on im "bold and historic leadership on behalf of freedom and justice".
Canada Foreign Minister Anita Anand say "Canada call on all parties to respect international law and we stand by di pipo of Venezuela and dia desire to live in a peaceful and democratic society".
Norway Foreign Minister Espen Barth Eide say "international law dey universal and binding for all states.
"Di American intervention in Venezuela no dey in accordance wit international law."
Since September, US don launch more dan 30 strikes on wetin e say be boats wey dem dey use for drug trafficking for di Pacific and di Caribbean, killing more dan 100 pipo.
Trump administration don describe di strikes on vessels for di Caribbean and eastern Pacific as attacks against terrorists attempting to bring fentanyl and cocaine to US, however authorities no provide evidence to back up im allegations.
With di exception of two survivors - one Colombian and Ecuadorean national - none of di identities of those on board dey made public.
Earlier dis week, di conflict enter anoda level when US carry out strike on one "dock area" linked to alleged Venezuelan drug boats.
Fentanyl dey produced mainly in Mexico and dey reach US almost exclusively via land through im southern border.
Counter-narcotic experts don also say Venezuela na relatively minor player in global drug trafficking.
E dey mainly act as a transit kontri from where dem dey smuggle drugs wey dem produce elsewhere.









