Israel ban UN Secretary General Antonio Guterres, UN oga reaction

UN Secretary General Antonio Guterres dey give speech at di United Nations in New York. E dey stand against di distinctive green marbled backdrop at lectern, wearing red tie, dark suit jacket and blue shirt

Wia dis foto come from, Reuters

    • Author, Michael Sheils McNamee
    • Role, BBC News
  • Read am in 3 mins

Di United Nations secretary general don condemn Iranian strikes on Israel, afta dem don ban am from di kontri for im initial response.

Speaking to di UN Security Council, António Guterres tok say time don reach to stop wetin e call di "deadly cycle of tit-for-tat violence" in di Middle East.

Inside one statement, Israel Foreign Minister Israel Katz declare Guterres persona non grata and "anti-Israel secretary-general wey dey lend support to terrorists".

Di comments dey come in response to Guterres initially call for ceasefire, but dem no mention di Iran attack.

Addressing di council, di UN secretary general tok say im condemn di attack in April, and "as e dey clear yesterday in di context of di condemnation I express, I again strongly condemn yesterday massive missile attack by Iran on Israel".

"Dis attack paradoxically no support di cause of di Palestinian pipo, or reduce dia suffering," e tok.

E also criticise Israel actions in di region, calling di military campaign in Gaza "di most deadly and destructive military campaign in my years as secretary general".

On Tuesday, Iran launch about 180 ballistic missiles into Israel, wit Israel saying most of dem na attack.

Inside one statement afta di attack on social media site X, formerly Twitter, Guterres say im condemn "di broadening of di Middle East conflict wit escalation afta escalation".

Bifor Guterres tok to di UN Security Council, Katz tok say anybody wey "no fit clearly condemn Iran evil attack on Israel no deserve to step foot on Israeli soil".

E specifically criticise Guterres for "im anti-Israel policy since di beginning of di war".

Tuesday attack by Iran na di latest in series of escalations, starting almost one year ago wit attacks on Israel by Hamas, and recently involving increase fighting between Iran-backed Hezbollah and Israel.

Wetin we call dis Video, Watch: View from above as Iran fire barrage of missiles towards Israel

Israel launch military campaign in Gaza in response to di unprecedented attack on southern Israel on 7 October by Hamas gunmen, wia 1,200 pipo die and 251 dey hostage.

Since di attack, military campaign in Gaza don kill total of 41,689 pipo, according to di Hamas-run health ministry.

Ova di course of di conflict, fight don dey betwin Israel and di United Nations about di situation in Gaza and di West Bank.

Also, Israel and di UN don dey get argument ova di role of di UN agency for Palestinian refugees, UNRWA.

In January, Israel allege say some of di agency staff members dey involved in di 7 October attack.

In response to dis, di agency launch investigation - wit international funders withdrawing support, bifor dem later reinstate dia funding. In August, dem dismiss nine staff members ova potential involvement in di attacks.

During di conflict, UNRWA criticise Israel for air strikes in Gaza, wey kill dia staff members.